
Who be di Ghana opposition party businessman 'Chairman Wontumi' wey authorities dey pursue?
Police and di economic and organised crime office (EOCO) dey pursue one ogbonge opposition party chairman ova plenti allegations.
Bernard Antwi Boasiako (alias Chairman Wontumi) bin dey under pressure as di state dey chase am about im involvement for illegal mining (galamsey) and oda financial crimes.
Dem bin rush di Ashanti regional chairman of di opposition NPP to hospital afta im allegedly fall sick during interrogation by EOCO.
Dem arrest Bernard Antwi Boasiako alias "chairman Wontumi" on Tuesday afta im report to di police CID office, a day afta dem grant am bail wit two sureties.
Di businessman chop accuse say im dey involve for illegal mining (galamsey), im dey pollute water bodies and also entering forest reserve without authorization wit im mining company.
Last week, security pipo don go im house for Kumasi wit search warrant but oga Wontumi im private security no allow di officers to enter di house - but im gree to report imsef for di police station on Monday 26 May.
Na so officers from EOCO don arrest di controversial opposition party chairman afta im visit di police CID Tuesday afternoon.
Party supporters and dia leaders gather wia dem spend di night for EOCO office to demand di release of dia chairman.
Dem cause kasala wit police and soldiers for dia wia some bin burn tyres wia dem dey chant.
Afta six hours of interrogation, Oga Wontumi say im fall sick wia dem rush am to hospital.
Im lawyer Andy Appiah Kubi confam say, "we neva finish di interrogation bifor my client fall sick, na so dem carry am go hospital."
"If dem bin treat am wey im dey fit, we go come back to continue di interrogation, unless di doctors tok say im no dey well."
Di arrest of chairman Wontumi dey in connection wit anoda mata different from di illegal mining allegations.
Im lawyer say "we don receive anoda writ of summons by Exim Bank wey we go respond to di mata, we go mount defence for our client – dis na civil mata, but for di ones wey be criminal case, we go mount defence for oga Wontumi."
Party leaders and di supporters tok say di way dem arrest dia chairman, no good.
National youth organiser Salam Mustapha say di way dem arrest dia party member na "rambo-style."
"Dis na democracy, di goment no fit to use state security to intimidate political opponents. Why dem go arrest pesin dis way? Dem fit to invite am wey im go present imsef. But to treat pesin like dis, na unfair."
Oga Wontumi no be di only officer for di opposition party wey dey under investigation for various allegations of corruption
Di former signals bureau boss Kwabena Adu-Boahene and im wife dey under trial say dem allegedly cause financial loss to di state wey dem also divert state funds.
Di former director and di board chairman for di Ghana infrastructure and minerals fund (GIIF) also bin dey before court ova one $2m sky train mata.
Di attorney general bin dey pursue oda former goment appointees ova alleged corruption among oda tins.
Who be chairman Wontumi and why e dey popular?
Chairman Wontumi na ogbonge pesin for di new patriotic party (NPP) – wey im be di chairman of di party for dia stronghold di Ashanti Region.
Im dey popular sake of some of di tins im dey tok and how im dey handle tins.
Im na old student of Prempeh College.
Di businessman man get plenty businesses – im get mining companies, im dey for di construction and oda industries.
For 2022, im declare say im wan buy Chelsea football club; im tok say im submit $3.1bn bid to buy di English club.
Di businessman also bin get media business – wit TV and radio station.
Three years ago, im carry wetin im describe as "pure gold" to im station wia im display for live TV.
"Dis na solid moni, dis na pure gold, we no dey joke for dis kontri. Solid moni," chairman Wontumi tok as im dey display five bars of gold for di TV.
Chairman Wontumi na one of di financiers of im party – na so im dey so powerful, especially during di last eight years under di NPP goment.
Many civil society groups bin dey petition di police CID under di Nana Akufo-Addo goment say Chairman Wontumi im mining companies dey involve for illegal mining for di forest reserves.
But di president at di time, Nana Akufo-Addo tok say di chairman company no dey involve for illegal mining even though di minister for lands and natural resources at di time, Samuel Abu Jinapor confam say di party chairman im company dey involve for illegal mining.
Di environmental groups bin petition di police CID again dis year afta di elections say make di police investigate am, na dat be one of di reasons wey dem invite am to di CID headquarters.
Despite im popularity for di NPP, im dey divide opinion among di party leadership.
Im wan rise from im post as Ashanti regional chairman to become di national chairman of di opposition party.
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


The Independent
13 hours ago
- The Independent
Brazil strikes deal with Musk's Starlink to curb criminal use in the Amazon rainforest
Brazil's Federal Prosecutor's Office announced Friday a deal with Elon Musk's Starlink to curb the use of its services in illegal mining and other criminal activities in the Amazon. Starlink's lightweight, high-speed internet system has rapidly spread across the Amazon, a region that for decades struggled with slow and unreliable connectivity. But the service has also been adopted by criminal organizations, which have used it to coordinate logistics, make payments and receive alerts about police raids. It's the first agreement of its kind aimed at curbing such use following years of pressure from Brazilian authorities. Starlink, a division of Musk's SpaceX, will begin requiring identification and proof of residence from all new users in Brazil's Amazon region starting in January. The company will also provide Brazilian authorities with user registration and geolocation data for internet units located in areas under investigation. If a terminal is confirmed to be used for illegal activity, Starlink has committed to blocking the service. The deal is for two years and can be renewed. Illegal gold mining has contaminated hundreds of miles of Amazon rivers with mercury and disrupted the traditional lives of several Indigenous tribes, including the Yanomami. Starlink, which first arrived in the region in 2022, has enabled criminal groups to manage mining operations in remote areas, where logistics are complex and equipment and fuel must be transported by small plane or boat. 'The use of satellite internet has transformed the logistics of illegal mining. This new reality demands a proportional legal response. With the agreement, connectivity in remote areas also becomes a tool for environmental responsibility and respect for sovereignty,' federal prosecutor André Porreca said in a statement. Illegal gold miners and loggers have always had some form of communication, mainly via radio, to evade law enforcement. Starlink, with its fast and mobile internet, has significantly enhanced that capability, Hugo Loss, operations coordinator for Brazil's environmental agency, told The Associated Press in a phone interview. 'They've been able to transmit in real time the locations of enforcement teams, allowing them to anticipate our arrival, which seriously compromises the safety of our personnel and undermines the effectiveness of operations,' Loss said. 'Cutting the signal in mining areas, especially on Indigenous lands and in protected areas, is essential because internet access in these locations serves only criminal purposes.' Jair Schmitt, head of environmental protection for the agency, said what's also needed is tighter regulation on the sale and use of such equipment. The AP emailed James Gleeson, SpaceX's vice president of communications, with questions about the deal, but didn't immediately receive a response. ___ The Associated Press' climate and environmental coverage receives financial support from multiple private foundations. AP is solely responsible for all content. Find AP's standards for working with philanthropies, a list of supporters and funded coverage areas at


BBC News
3 days ago
- BBC News
I no go resign - Suspended Chief Justice Gertrude Torkornoo tackle Ghana govment over 'unfair hearing'
Di Chief Justice wia Ghana president don suspend don speak out for di first time since dem begin impeachment processes against her. Justice Gertrude Torkornoo, wey be chief Justice since 2023, chop suspension afta at least three separate pipo file petition to president John Mahama say make dem remove am from office. Di president afta im receive di three petitions forward dem to di council of state wia suppose study di petition and determine whether she gat case to answer based on dis allegations for di petitions. Na so di council advise di president say di CJ get cases to answer wia president Mahama sign warrant to suspend her from office. Di president also set up five-member committee say make dem investigate di petitions and hear di side of di chief Justice. Afta di committee finish dia hearings, dem go recommend whether di allegations dey strong enough to remove her from office or not. Since di committee begin to dey hear di matter on 15 May 2025, di suspended chief Justice and oda lawmakers don carry di case go di supreme court say make dem stop di process and declare am illegal. But di Supreme Court for all di five cases, don dismiss di mata wia dem tok say di 5-member panel neva do anytin wrong so far for di impeachment process. Goment bin tok say dem only dey follow di constitution wia don provide di process to remove chief Justice and oda commissioners. Di law tok say di panel hearings gatz dey behind closed doors but since di beginning, some of di tins don leak. Na so goment warn di suspended chief Justice say make she no leak di content of di petition wia di president don send give her to respond. But inside supplementary affidavit wia di suspended chief Justice don file for di Supreme Court, di CJ tok say di 5-member panel don dey abuse her rights na so she wan make di court stop di process. Di Supreme Court bin dismiss her affidavit by majority decision say she dey carry tins wey dey happun behind closed doors for di panel into di public, against di law. Afta more than one month of di panel hearing, di suspended chief Justice don address press conference wey she tok say di whole process na "staged tin to remove her from office." Some of di tins di suspended CJ tok Di panel don abuse my rights for di hearing "I bin apply to di Supreme Court say make dem scrap di provision wey say make di hearing dey behind closed door, and make dem do am for public, but di court no gree," Justice Gertrude Torkonoo tok. 'Di allegations against me neva be true' Di suspended chief Justice also state some of di allegations inside di petitions wia she tok say dem neva be enough grounds to remove her from office "I neva make any decision for di court on my own, di decisions by di Supreme Court na court decision even if I bin dissent wit my view." She add say "di chairman of di panel wey dey hear di mata na Supreme Court judge wey also bin on top one case wey involve di petitioner dey raise conflict of interest." "Dem bin accuse me say I carry my husband and my daughter to go for vacation outside di kontri two times, wia I use state moni, but for dis two vacation wia I bin dey within di judicial service conditions of service," Gertrude Torkornoo explain. "Di conditions provide say di CJ gat to travel wit at least one pesin everytime, na so I choose to travel wit my husband and daughter on different occasions - for those trips, we even return some of di per diem up to $9.6K two days afta I don return afta I bin spend only $4,400 out of di $14,000 dem carry give me." On di allegation say she bin write to di former president Nana Akufo-Addo say make im appoint five new judges to di Supreme Court for 2024, without consulting di judicial service, di Ghana bar association and oda groups; di suspended CJ say she neva do anitin wrong. 'I no go resign, I go fight dis mata' Di suspended chief Justice tok say pipo don tok am say make she resign sake of di wahala don plenty wia di Supreme Court don also dismiss five cases against di impeachment process. But Gertrude Torkonoo say she neva go resign. "My loved ones and oda pipo bin dey call me say make I resign so say dem go stop to dey drag me for dis mata, but if I resign, e go send wrong signal say when I gatz to stand up for di law, I run away." Justice Torkonoo further add say "even tho pipo bin dey threaten me wia some dey tok say if I comot dis mata and still remain chief Justice, dem go make I suffer, I go still pursue di mata." "I neva go Sidon make dis flawed and opaque process to stand wia I no go tok. If I no tok, dis calculated process to achieve political agenda based on false claims, go become precedent for Ghana," Also "for my ova 30 years of practise as a lawyer, and ova 20 years as a judge for dis kontri, I neva collect bribe bifor, na so my integrity dey intact." Goment respond to di suspended Chief Justice press conference Goment don address counter press conference afta di chief Justice im press conference wia dem tok say some of di tins di CJ tok, no be true. Tok tok pesin for di goment Felix Kwakye Ofosu say "di venue for di panel hearing (Edu Lodge) na goment facility wia di committee vim request to use di area to prevent leaking of tins during di committee hearings." "To tok say di venue dey calculate to intimidate her na unfair to di goment, wia di venue gat no link wit wetin she tok say na di Venue dem plan wia dem kill three judges in 1981, as di chief Justice tok." Oga Felix Ofosu Kwakye him add say "nobody fit point to one step wia di president don follow so far dey against di constitution, na di CJ wia don breach di law when she carry di mata enta public against di law." For di mata about threats to her life, Felix Kwakye Ofosu tok say di CJ sabi wia she gatz to report issues of threat, no be di media, na di police. Already sabi pipo bin suggest say di suspended chief justice day in contempt; as she carry di mata enta public when di law say make di panel hearing and di details of di petitions dey "in-camera". Odas tok say wetin she gate do na to go thru di hearing process and afta if she think say she no free wit di recommendations of di committee, she fit to challenge di mata for court.


Reuters
3 days ago
- Reuters
Ghana approves $2.8 billion debt relief deal with creditor nations
ACCRA June 25 (Reuters) - Ghana's parliament approved a $2.8 billion debt restructuring deal late Tuesday with 25 creditor nations, including China and France, aiding disbursements under an IMF bailout programme to alleviate the country's worst economic crisis in decades. The West African nation, the world's second-largest cocoa producer, signed a memorandum of understanding with its creditors in January after defaulting on most of its external debt in December 2022. The 25 participating creditor countries also include the United States, Germany, and the United Kingdom, demonstrating broad international support for Ghana's economic recovery. The International Monetary Fund (IMF) approved a $3 billion, three-year bailout for Ghana in May 2023 that helped stabilise Ghana's economy and led to a Fitch rating revision. "The terms of the debt treatment offer a debt service relief of $2.8 billion during the Fund-supported programme period (2023-2026)," a parliamentary report seen by Reuters said. Under the restructuring terms, debt service payments due between December 20, 2022, and December 31, 2026, will be rescheduled, capitalised, and repaid from 2039 to 2043, delaying repayments by over 15 years, the report said. The Official Creditor Committee set interest rates at 1% to 3% to capitalise rescheduled amounts, depending on the original contractual rate, offering Ghana's treasury savings below market levels, the report said. "The Committee noted that the debt restructuring was critical in supporting government to restore and sustain macroeconomic stability and debt sustainability," the report concluded, with lawmakers unanimously recommending approval. Ghana continues negotiations with commercial creditors to complete its debt restructuring.