logo
Viral video catch wia pipo dey beat Rivers LGA Sole administrator, police take action

Viral video catch wia pipo dey beat Rivers LGA Sole administrator, police take action

BBC News22-06-2025
Rivers state police don condemn di attack on di sole administrator of Ahoada-East Local goment area, Goodluck Iheanachor and invite im chief of staff to come answer kwesion on di matter.
Police claim say Hector Ekakita, wey be di chief security officer and di Chief of staff to di sole administrator allegedly storm di council secretariat wit 30 jaguda pipo, wey attack oga Iheanacho.
Di attack happun on Friday 20 June for di council secretariat according to police.
During di attack, di jaguda pipo beat di Sole Administrator, tiff im mobile phones, force am to sign im letter of resignation, den go away vital documents, including official and personal documents from im office, police tok.
Dis incident dey happun few months afta im appointment by Vice Admiral Ibot-Ete Ibas di Sole Administrator of Rivers State.
Police say Iheanacho dey hospital wia im dey currently collect medical treatment sake of di injuries wey e get during di violent attack. Im dey stable condition.
Meanwhile di commissioner of Police, Olugbenga Adepoju, visit di scene of attack wit heads of oda sister security agency for di state and vow to take action.
Viral video
For di viral video, Honourable Iheanacho wear grey native sitdom for ground surrounded by di Jagudu pipo.
Di jaguda pipo flog di sole administrator of Ahoada and shout on am to sign di document wey dem give am.
Rivers state emergency rule
Na March 18, 2025, President Bola Tinubu declare state of emergency for Rivers state and suspend di governor, im deputy and all lawmakers for di state parliament for six months.
For one nationwide broadcast on Tuesday evening Tinubu say im receive "disturbing security reports wia im detail incidents of vandalization of pipelines by some militants without di govnor taking any action to curtail them".
Im add say im no allow di "grave situation" to kotinu.
But lawyers and opposition politicians dey kwesion di legality of di president decision.
Tinubu bin make di announcement afta one of di kontri highest producing crude oil pipelines, di Trans-Niger Pipeline, bin suffer significant damage sake of blast.
In di past criminal gang or militant don carry out attack on pipelines wey, halt production and exports.
At current prices, the oil flowing through the affected pipeline fetches around $14m (£11m) a day, according to the online publication Africa Report.
But against the backdrop of the blast, there has been a political rift in Rivers state that has reached boiling point.
Govnor Siminalayi Fubara na member of di People Democratic Party wey dey face serious wahala.
PDP na di main opposition party to di president's All Progressives Congress.
Tinubu say politicians no bin fit work togeda effectively sake of di wahala. Im allege say Fubara allies bin threaten "fire and brimstone" against di govnor enemies and dem no "disown" dis comments.
Rivers state lawmakers bin threaten to impeach di govnor and im deputy.
Tinubu say dis political crisis don leave Rivers state im "standstill" im add say dis im move dey based on di need to restore peace and order for di state.
Fubara react to di state of emergency, im say na "political disagreements, but good governance dey kotinu".
"Rivers state dey safe, secure and peaceful under our watch," im tok.
Di state of emergency allow di goment to run di state in di interim and dem go send security forces if needed.
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Elephant kills 2 female tourists from the UK and New Zealand in Zambian national park
Elephant kills 2 female tourists from the UK and New Zealand in Zambian national park

The Independent

time34 minutes ago

  • The Independent

Elephant kills 2 female tourists from the UK and New Zealand in Zambian national park

Two elderly female tourists in Zambia were killed by an elephant Thursday while on a walking safari in a national park, police said. Eastern Province Police Commissioner Robertson Mweemba said the victims — 68-year-old Easton Janet Taylor from the U.K. and 67-year-old Alison Jean Taylor from New Zealand — were attacked by a female elephant that was with a calf. Safari guides who were with the group attempted to stop the elephant from charging at the women by firing shots at it, police said. The elephant was hit and wounded by the gunshots. The guides were unable to prevent the elephant's attack and both women died at the scene, police said. It happened at the South Luangwa National Park in eastern Zambia, around 600 kilometers (370 miles) from the capital, Lusaka. Female elephants are very protective of their calves and can respond aggressively to what they perceive as threats. Last year, two American tourists were killed in separate encounters with elephants in different parts of Zambia. In both cases, the tourists were also elderly women and were on a safari vehicle when they were attacked. ___

Peter Obi explain im involvement with ADC as Labour Party give am 48 hours to resign
Peter Obi explain im involvement with ADC as Labour Party give am 48 hours to resign

BBC News

time38 minutes ago

  • BBC News

Peter Obi explain im involvement with ADC as Labour Party give am 48 hours to resign

Di Nigeria Labour Party, LP, don give Peter Obi, di party presidential candidate for di 2023 general elections 48 hours to formally resign from di party. Dis dey come as di former Anambra state govnor join one coalition opposition figures wey don adopt di African Democratic Congress (ADC) as dia new party. Di former presidential candidate of di Labour Party for di 2023 election, Peter Obi, say di African Democratic Congress, ADC coalition go always put Nigerians first for all dia decisions. E tok dis one afta e show im support for di ADC, as di party di coalition of top opposition figures for di country chose as platform to unseat di ruling All Progressives Congress (APC) for di 2027 general elections. Oga Obi say di decision to join ADC no easy but dia commitment na to sacrifice and work togeda to provide competent and compassionate leadership for Nigeria. "Dis decision no come lightly. E come from deep reflection on wia we dey as a kontri and wetin we must do to move forward. "No one group fit change Nigeria alone. To scata di structures wey keep our pipo for poverty and insecurity, we must build bridges, no be walls even wen those bridges no dey easy. 'We give you 48 hours' Di National Publicity Secretary of di Labour Party Obiora Ifoh for one statement say dia party no get interest to join di coalition, plus members of di coalition na "power mongers wey dia only interest na for dia self no be di pipo." Oga Ifoh also add say na those wey mismanage Nigeria ova di years gada themselves togeda for di coalition, as e note say, "desperate politicians no fit birth new Nigeria." Di Labour party for di statement reveal say dem dey aware say Oga Obi dey lobby dia members to join am for di new party. "We dey aware of several night-time meetings between Peter Obi and some of our members, as e dey lobby dem to join am for im new party. We also know say some of dem don refuse to defect wit am. "Labour Party don consistently tok am say dem no be part of coalition and any of our members who dey part of di coalition get 48 hours to formally resign im membership from di party," di party tok-tok pesin tok. Leaders of main opposition parties join di ADC No be only di former LP presidential candidate join di coalition, di presidential candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) Atiku Abubakar also join di new party. Di two pipo be di main opposition leaders, and dem hope say through dis coalition dem go fit challenge President BolaTinubu and im ruling party for di next election. Di two opposition leaders chose di African Democratic Congress (ADC) as dia new political home afta dem break away from dia respective parties – di Peoples Democratic Party (PDP) and di Labour Party (LP). Some political heavyweights from Oga Tinubu All Progressives Congress (APC) party don also throw dia weight behind di formation. Obi and Abubakar go fit work togeda again? Dis na di question for di lips of many, as Obi large support base no wan see am dey play second fiddle to anyone else - and dis na why e comot di PDP to join di Labour Party for di last election. While Abubakar supporters feel say as e be di only former vice-president wey dey fight for di presidency, every oda politician naturally come second. Wen di two politicians work togeda for 2019, wit Obi serving as Abubakar running mate, dem lost to APC Muhammadu Buhari. Wen Obi leave di PDP for LP for 2022, na peaceful separation wey no get issue. Di former govnor bin tok at di time say im dey move go LP bicos e align wit im aspirations. As if both of dem know say fate go bring dem back togeda, dem no tok bad of each oda either bifor or during di 2023 campaign. E go dey interesting to see how tins go work out between now and 2027. Di ADC na new party? ADC na party wey don already dey exist, e get acronym wey close to di All Democratic Alliance (ADA) dem bin wan register. Founded in 2005 as di Alliance for Democratic Change by Mr Ralph Nwosu - a politician from Awka, Anambra State, in di southeast region of Nigeria - di party later change dia name to African Democratic Congress and dia slogan na 'Arise and Shine Nigeria'. Inec register dem in 2006 ahead of di 2007 general elections wia di party bin get candidates but dem no win any position. Dia first presidential candidate na Professor Pat Utomi who get just about 50,849 votes for dat election. Dia first win bin come in di 2011 elections wia dem win some five seats for di National Assembly. From di 2007 general election till date, di ADC don put out presidential candidates for each election: Di ADC primary election for di 2023 general election bin cause plenty controversy as two big aspirants - former deputy govnor of Central Bank of Nigeria, Kingsley Moghalu and Dumebi Kachikwu face-off. Eventually, Kachikwu win di primary and contest di election wia e get only 78,930 votes.

Murderer who planned gun attack on prison officer given 10-year sentence
Murderer who planned gun attack on prison officer given 10-year sentence

The Independent

timean hour ago

  • The Independent

Murderer who planned gun attack on prison officer given 10-year sentence

A convicted murderer who plotted a gun attack on a prison guard has been given a sentence of more than 10 years. Robert Paterson, 45, planned the attack in an act of 'revenge', believing the officer at HMP Edinburgh had put his life at risk with a delay in sending him to hospital after he swallowed seven bags of cocaine. The plot was foiled when police eavesdropped on conversations Paterson was having about the plan through 'covert' surveillance equipment they had installed in his cell in early 2023. At a sentencing hearing at the High Court in Edinburgh on Thursday, judge Lord Harrower explained the origins of Paterson's 'animus' towards the officer. The judge said that shortly before 2am on November 15, 2022, the officer heard Paterson 'scream he was having a heart attack' from inside his cell, and 'demanded' he be taken to hospital. He said the officer had seen Paterson swallowing a sim card he had just removed from a mobile phone, and staff at the prison were surprised to see an ambulance arrive when none of them had ordered it. Paterson's 'vital signs' were deemed healthy so he was kept in prison under observation for a few hours, before being taken to the Royal Infirmary of Edinburgh shortly before 8am. Lord Harrower added the officer had been 'aware' of an attempt by Paterson to escape when admitted to hospital in 2012, but said there was no indication the episode had been 'another attempt' to break out of jail. Once at hospital Paterson was given a CT scan, and underwent surgery to remove seven plastic bags of cocaine from his stomach. The judge told Paterson that following his return to prison he began to 'seek revenge' against the officer, believing he had been the cause of an 'unnecessary delay' in sending him to hospital. He set about obtaining a handgun and ammunition, and 'identified an individual who was prepared to carry out an assault' in return for 'drugs or money'. He also discussed procuring a vehicle and driver to be used in the assault. Thanks to the surveillance equipment police had installed in Paterson's cell, police got wind of the plan and 'intervened before an assault had been attempted'. Lord Harrower told Paterson: 'It is clear your proper purpose was conspiring to commit a serious crime.' Paterson's advocate Thomas Ross KC earlier told the court his client had reacted after deeming 'the manner in which the medical emergency was handled increased the risk of a fatal outcome'. On May 2 this year, Paterson pleaded guilty to directing others to carry out an assault, and obtaining for that purpose a handgun, ammunition and a vehicle. He also admitted directing and arranging the supply of drugs, and to directing others to steal drugs, watches and money. He is currently serving a life sentence for murder and is not due to become eligible for parole until 2027. Lord Harrower sentenced Paterson to 10-and-a-half years in prison for his latest offending, with the sentence to begin immediately. Paterson, who appeared in court dressed in a pale brown fleece, showed no reaction as the sentence was handed down. He nodded and waved to people in the public gallery as he was led from court. Speaking after the sentencing hearing, Scottish Prison Service chief executive Teresa Medhurst said: 'We welcome the significant custodial sentences passed today at Edinburgh High Court. 'As Lord Harrower rightly identified, the officer in this case acted 'entirely appropriately' and it is completely unacceptable that he, or any other member of SPS staff, be targeted in this way. 'The safety of our staff is absolutely paramount. We will continue to work closely with partners across the justice sector, to ensure that all necessary action is taken to protect those who play a vital role in keeping Scotland safe.'

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store