logo
Ghana reply after US slam dem with three months visa restriction too

Ghana reply after US slam dem with three months visa restriction too

BBC News11-07-2025
Di govment of Ghana don confam say di US bin take action to revise dia policy to issue prospective travellers three months visa instead of five years.
Tori bin dey dis week say di US govment don apply dis three-month restriction to most immigrant visas wey include B-class (business/tourism) and F-1 (student) visas for some African kontris including Nigeria and Cameroon.
Na so di foreign ministry of Ghana now don confam say di policy affect Ghana also for wetin di US describe as visa reciprocity.
According to di US state department bureau of consular affairs, holders for A-class visas wia be diplomats and govment officials go continue to receive multiple-entry visas wit validity from 24 to 60 months.
Dis updated guidelines wey dem publish under di US visa reciprocity and civil documents for Ghana, also affect student visa applicants wey dey enrolled for full time academic programmes for di US.
Dem also go get only one entry visa wey go expire afta three months.
Wetin di foreign ministry tok about dis visa restriction
Inside one statement by di foreign ministry on Friday, govment tok say "dis decision by di US dey different from di arrangement wey Ghana bin get wit di US."
According to di foreign Affairs Minister Samuel Okudzeto Ablakwa, Ghana bin still dey issue five years multiple entry visas for US passport holders.
In fact, di ministry tok say dia embassy for Washington DC and New York since January don issue ova 40,000 visas.
Out of dis number, 28,626 of dem na multiple entry visas to Ghana.
"Consistent wit di bilateral relations, US passport holders dey entitled to maximum visa validity of five years."
"But some of di applicants bin dey apply for single entry visas based on di validity of dia passports," di statement tok.
Tori bin dey go round during di week say di US don take dis decision sake of Ghana bin revise dia visa policy wit di US wey dem reduce am from five years to three months.
But di foreign affairs ministry deny dis mata.
According to Oga Samuel Okudzeto Ablakwa, Ghana don issue 70.42% of multiple long-term visa to di US passport holders according to bilateral relations between di two kontris.
"Aside di five-year multiple visas, Ghana also bin dey issue entry visa for six months, one year, two years, three and four years based on various considerations."
Di ministry too say dem bin dey work with di US govment to deal wit di mata wey don cause dis visa restriction in di first place.
Currently, di rate of visa overstay for Ghanaians for di US na 21% wey be above di acceptable level of 15%, according to di foreign affairs ministry.
Di ministry say, "di US don tell us say di main reason for dis visa restriction, na sake of pipo wey dey overstay dia visa duration - wey include students."
"Govment dey study di current development to consider dia options, but we dey committed to working wit di US govment to deal wit dis mata."
"We dey hope to fix dis mata especially as di US confam say di ogbonge reason for dis restriction na visa overstays - so we dey ensure say applicants align wit di visa application procedures and requirements for di US," di foreign affairs ministry add.
Nigeria, Ethiopia and Cameroon bin confam say di US don impose same restriction for dia citizens as well.
Nigeria don deny say im dey issue single-entry e-visas for three months to US citizens.
Presidential tok-tok pesin Bayo Onanuga tok on Thursday say Nigeria still dey offer multiple entry visas to American citizens.
Likewise, di US citizens fit get up to one year for Cameroon and 90 days for Ethiopia.
'Dis arrangement go affect plenty tins'
One former lawmaker for Ghana bin dey share im experience wit di new visa restriction policy.
Oga Ras Mubarak wey be former member of parliament for Kumbungu explain wetin im go through when im five-year visa bin expire.
"My visa expire for January dis year wey I apply to renew ; na so dem issue three-month single entry visa instead of di five years," oga Ras Mubarak write for im social media handle.
"Dis kind arrangement go affect many tins, tourism, business and education sake of pipo no fit to dey apply every three months for dia trips - dis na increasing cost and also go cause plenty administrative kasala."
Im add say, "no serious business pesin go put diasef through dis kind wahala, e no dey economically wise to apply for visa to di same kontri every three months."
"Pipo go now decide to explore oda markets for business, tourism and education wit di way di US now dey go."
Di former lawmaker say im now dey lead one campaign to begin road-trip from Accra to 39 African kontris to meet dia govments and promote visa-free policy for Africans wey dey travel for Africa to boost economy and create opportunity for African pipo.
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

NLC reject policy wey wan stop workers from going on strike in Nigeria
NLC reject policy wey wan stop workers from going on strike in Nigeria

BBC News

time11 hours ago

  • BBC News

NLC reject policy wey wan stop workers from going on strike in Nigeria

Di labour union for Nigeria wey be di Nigeria Labour Congress (NLC) don criticise di National Industrial Relations Policy (NIRP) wey Nigeria govment recently adopt. Nigeria govment on Thursday afta di Federal Executive Council, FEC, meeting bin tok say dem don adopt a new policy wey go control di way unions dey go on strike. ‎Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, na im announce di decision afta di FEC meeting on Thursday.‎ Oga Mohammed Idris explain say di NIRP go guide trade unions, employers, and govment agencies. E go also promote beta tok-tok wey dey in line wit labour practices for Nigeria wey go also meet international standards. ‎‎"Di policy na major step forward to address di long-standing gaps for how we dey manage labour relations for Nigeria," But NLC say di main aim of dis newly adopted policy na to stop di workers from going on strike, especially strikes by trade unions, as pipo dey always criticise govment for dis strikes. For statement wey di NLC President, Joe Ajaero sign, di labour union say e shock dem say out of di hundreds of workplace issues wey dey inside di National Industrial Relations Policy, di federal govment only pick out di industrial strikes sake of say na dat one dey give dem headache. "Di unfortunate press statement don expose di mindset of di pipo wey we elect to protect di interests of di ordinary citizen, including workers. NLC also para on how govment use strong-arm tactics to overturn popular decisions through a process of tripartism (three parties wia goment, employers through dia representative and workers agree on sometin) through di process of social dialogue. " NLC tok say wen dem bin dey develop di National Industrial Relations Policy for Nigeria, govment bin wan put some clauses for di policy wey go make strike actions criminal. Di statement add say di trade unions, di employers and even di representatives of govment bin reject am sake of say e no follow di 1999 Constitution and di Trade Unions Act wey give trade unions di power to withdraw dia services in line wit di law. "Di right of a worker and trade unions to withdraw dia services dey fundamental and dem no go fit remove am. Why govment remember dis policy According to NLC, di policy dey since and e cover plenti labour issues for Nigeria but govment remember to pick and adopt only di part wey relate to strike. Nigeria govment adopt am for di FEC meeting on Thursday afta di National Union of Nigeria Nurses and Midwives bin start a seven-day warning strike on Wednesday. Nigeria govment bin announce say di nurses and midwives don suspend dia strike on Friday, but di nurses deny suspension of strike, afta FG tok am. Di nurses begin strike afta dem give 15-days ultimatum to Nigeria govment.

I no dey identify as Nigerian again
I no dey identify as Nigerian again

BBC News

time12 hours ago

  • BBC News

I no dey identify as Nigerian again

Conservative Party leader Kemi Badenoch say she no dey identify herself as Nigerian and she say, she never renew her passport since early 2000s. Na UK Badenoch parent born her, but she grow up for both Nigeria and US. She return to England at di age of 16 because of Nigeria political and economic climate wahala, so she go back to continue her education. For former MP and television presenter Gyls Brandreth Rosebud podcast, she say she be "Nigerian through my ancestors" but "by identity, I no really be Nigerian". Last year, Nigeria vice-president bin criticise Badenoch, im say she dey "attack" di West African country. Badenoch, wey bin live for Lagos, tok well-well about her upbringing for di podcast. "I know di country very well, I get a lot of family dia, and I dey very interested for wetin dey hapun dia," she tok. "But home na wia my family dey now." On dis issue of renewing her passport, she say: "I no dey identify wit am (she mean di Nigerian passport). Most of my life na for UK and I no tink say I need am." She add say: "I be Nigerian through my ancestors, by birth, even though dem no born me dia, because of my parents... but by identity, not really." Badenoch say wen she visit di country wen her father die, she bin need to get visa, according to her, di process "bin get as e bi". She say her early experiences for Nigeria shape her political outlook, including "why I no like socialism". As a child, "I remember say I no feel like say I belong dia", she tok as she add say "wen I come back to di UK for 1996, I feel say: dis na home". Di Tory leader add put say di reason she bin return back to UK na "a very sad one". "My parents bin reason am say: 'No future for you for dis country'." She say she neva experience racial issue for UK "in any meaningful form", she add say: "I know say I dey go place wia I go look different to everybody, and I no tink say e dey odd. "Wetin I find interesting na say di pipo no treat me differently, and na why I dey quick to defend di UK whenever di issue of racism come up." At di end of last year, some pipo bin criticise Badenoch sake of wetin she tok say she bin grow up in fear and insecurity for Nigeria during di time wen di kontri bin dey face serious corruption issues. Di country vice-president Kashim Shettima respond say im govment dey "proud" of Badenoch "in spite of her efforts to attack her nation of origin". Tok-tok pesin for Badenoch bin reject di criticism.

Kemi Badenoch says she no longer identifies as Nigerian
Kemi Badenoch says she no longer identifies as Nigerian

Sky News

time15 hours ago

  • Sky News

Kemi Badenoch says she no longer identifies as Nigerian

Kemi Badenoch has said she does not see herself as Nigerian and no longer has a passport for the country she grew up in. The leader of the Conservative Party was born in the London suburb of Wimbledon but was raised in Lagos, Nigeria. When Nigeria's economy collapsed in the 1990s, Ms Badenoch, then aged 16, moved back to the UK to live with a family friend and continue her education. Speaking to former MP and television presenter Gyles Brandreth on the Rosebud podcast, Ms Badenoch said as most of her life has been in the UK, she "does not identify" as Nigerian. "I'm Nigerian through ancestry, by birth, despite not being born there because of my parents... but by identity I'm not really," the North West Essex MP said. "I have not renewed my Nigerian passport, I think, not since the early 2000s." Ms Badenoch added that her home is now where her family is, which includes her extended political family. On Nigeria, she said: "I know the country very well, I have a lot of family there, and I'm very interested in what happens there." "But home is where my now family is, and my now family is my children, it's my husband and my brother and his children, in-laws. The Conservative Party is very much part of my family - my extended family, I call it," she added. Ms Badenoch said on her return to Nigeria after her father, Femi, who was a GP with his own clinic, died, she faced a "big fandango" to get a visa. She also said her early experiences in Nigeria shaped her political outlook, including why she doesn't like socialism. "I remember never quite feeling that I belonged there," she added. Last year, Nigerian vice president Kashim Shettima accused Ms Badenoch of disparaging the country, adding that she has "every right to remove the Kemi from her name". The criticism came after Ms Badenoch spoke about her life and childhood in Nigeria during the Tory leadership race. A spokesperson for Ms Badenoch responded to Mr Shettima at the time, saying the Conservative leader was "not the PR for Nigeria".

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store