
Nnamdi Kanu order im fighters to bury Ipob commander wit 2000 human heads - Witness tok for court
Dis witness, Mr DDD, na di fourth pesin wey di Nigeria goment dey call since di trial begin, and im na official of di Department of State Services, DSS wey work for Imo State betwnee 2019 and 2022.
E also narrate to court how DSS use some ogbonge digital tools to geolocate and recover di radio transmitter wey Kanu bin allegedly import into di kontri.
Dem later locate di container for di house of one Benjamin Madubugwu for one community for Ihiala in Anambra State wey im name na Ubuluisiuzor.
"Di transmitter dey inside container, but dem use oda household items like mattresses, washing machine and oda tins to cover am," Mr DDD tok.
DSS also search di house of Madubugwu and recover two pump action guns for im bedroom, so dem arrest am.
According to di DSS witness, Madubugwu tell dem say one man - Igwe Anyiba - bin beg am to keep di container for im house, and e go keep di empty container afta di owner collect wetin dey inside.
Mr DDD also say wen dem arrest Nnamdi Kanu, dem bring am face to face to Benjamin Madubugwu, and Kanu admit bifor am say na im get di container and di transmitter.
However, during cross examination, Onyechi Ikpeazu who be one of Kanu lawyers tell di court say na one Denca clearing and forwarding agency bin import and clear di container from di port, no be Nnamdi Kanu.
Kanu order im fighters to bury dia commander wit 2000 human heads
Also during im testimony, Mr DDD tell di court about one Ipob commander - Benjamin Uzoma, a.k.a Onye Army - wey police arrest and e confess to plenty crime wey e bin commit.
Adegboyega Awomolo, lawyer of di Federal Goment, present di court one Vanguard Newspaper of July 3, 2021 wey contain di report of di arrest.
For inside di newspaper article, di suspect - Onye Army - confess say Nnamdi Kanu order dem to use 2000 human heads to bury one of dia commander Iko Nso, wey police bin kill, and so far, dem bin don kill 30 pipo bifor police arrest am.
Also, di publication quote say Onye army also confess say Nnamdi Kanu order dem to kill security officials, members of di Eastern Security Network (ESN) use 10 virgins to do juju to protect diasef, and say ESN and Ipob fighters na di pipo wey attack di Imo State Prison.
Mr DDD tok say di DSS bin wan interview di suspect but police tell dem say e don escape from custody and dem neva find am reach now.
Di witness also narrate how DSS officials conduct raids for Ipob camps inside Orsu for Imo State and Lilu for Anambra State, wia dem kill some ESN fighters but also find out say di Ipob fighters dey engage in cannibalism to fortify diasef.
In total, Mr DDD say di number of security officials wey Ipob/ESN pipo bin kill for di region na between 170 and 200, including Police pipo, Immigration pipo, DSS pipo, Civil Defence pipo and Army pipo.
E say for one instance, di group attack one police station for Njaba, kill evribodi dia and start to dey use di station as dia base; e hard bifor security pipo pursue dem from dia.
"Dis Ipob pipo dey always move in large numbers, dem dey carry arms, dem go block road and snatch cars from pipo to take go operation, and sometimes, dem dey inform communities say dem go attack," di witness tok.
Mr DDD also tell court say na Ipob/ESN fighters kill Ahmed Gulak, a chieftain of di All Progressives Congress (APC) who bin visit Imo State on di invitation of di Govnor, Hope Uzodinma.
E say dem kill am on May 30, wey be di day Kanu order sit-at-home.
However, during cross-examination, Onyechi Ikpeazu, one of Kanu lawyers point out say Gulak na politician, and na im be di chairman of di primary election wey produce Uzodinma as di APC govnorship candidate for Imo State.
Ikpeazu ask di witness why e be say di killers kill only Gulak, but dem no touch di driver of im vehicle and di oda passenger wey dey wit am dat time.
E also point out say di govment of Imo State later come out to explain say di killing of Gulak dey politically motivated.
Ikpeazu also ask di witness weda e hear di broadcast wia Nnamdi Kanu dey condemn attacks on public facilities like markets, churches, mosques, etc, and DDD say e hear am.
Di witness bin don tok earlier say Kanu broadcasts show say e hate anybodi wey no be Igbo, but Ikpeazu ask am weda Ipob attack di Yoruba and Hausa communities for Onitsha in Anambra State, and e say no.
Afta di cross-examination, Justice Omotosho adjourn di matter to Thursday, 19 June, 2025 for continuation and for di prosecution to possibly close dia case.
Di charges against Nnamdi Kanu
Dis na di seven-count charges wey di Nigeria goment bin sama against Nnamdi Kanu:

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


BBC News
4 hours ago
- BBC News
NLC reject policy wey wan stop workers from going on strike in Nigeria
Di labour union for Nigeria wey be di Nigeria Labour Congress (NLC) don criticise di National Industrial Relations Policy (NIRP) wey Nigeria govment recently adopt. Nigeria govment on Thursday afta di Federal Executive Council, FEC, meeting bin tok say dem don adopt a new policy wey go control di way unions dey go on strike. Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, na im announce di decision afta di FEC meeting on Thursday. Oga Mohammed Idris explain say di NIRP go guide trade unions, employers, and govment agencies. E go also promote beta tok-tok wey dey in line wit labour practices for Nigeria wey go also meet international standards. "Di policy na major step forward to address di long-standing gaps for how we dey manage labour relations for Nigeria," But NLC say di main aim of dis newly adopted policy na to stop di workers from going on strike, especially strikes by trade unions, as pipo dey always criticise govment for dis strikes. For statement wey di NLC President, Joe Ajaero sign, di labour union say e shock dem say out of di hundreds of workplace issues wey dey inside di National Industrial Relations Policy, di federal govment only pick out di industrial strikes sake of say na dat one dey give dem headache. "Di unfortunate press statement don expose di mindset of di pipo wey we elect to protect di interests of di ordinary citizen, including workers. NLC also para on how govment use strong-arm tactics to overturn popular decisions through a process of tripartism (three parties wia goment, employers through dia representative and workers agree on sometin) through di process of social dialogue. " NLC tok say wen dem bin dey develop di National Industrial Relations Policy for Nigeria, govment bin wan put some clauses for di policy wey go make strike actions criminal. Di statement add say di trade unions, di employers and even di representatives of govment bin reject am sake of say e no follow di 1999 Constitution and di Trade Unions Act wey give trade unions di power to withdraw dia services in line wit di law. "Di right of a worker and trade unions to withdraw dia services dey fundamental and dem no go fit remove am. Why govment remember dis policy According to NLC, di policy dey since and e cover plenti labour issues for Nigeria but govment remember to pick and adopt only di part wey relate to strike. Nigeria govment adopt am for di FEC meeting on Thursday afta di National Union of Nigeria Nurses and Midwives bin start a seven-day warning strike on Wednesday. Nigeria govment bin announce say di nurses and midwives don suspend dia strike on Friday, but di nurses deny suspension of strike, afta FG tok am. Di nurses begin strike afta dem give 15-days ultimatum to Nigeria govment.


BBC News
4 hours ago
- BBC News
I no dey identify as Nigerian again
Conservative Party leader Kemi Badenoch say she no dey identify herself as Nigerian and she say, she never renew her passport since early 2000s. Na UK Badenoch parent born her, but she grow up for both Nigeria and US. She return to England at di age of 16 because of Nigeria political and economic climate wahala, so she go back to continue her education. For former MP and television presenter Gyls Brandreth Rosebud podcast, she say she be "Nigerian through my ancestors" but "by identity, I no really be Nigerian". Last year, Nigeria vice-president bin criticise Badenoch, im say she dey "attack" di West African country. Badenoch, wey bin live for Lagos, tok well-well about her upbringing for di podcast. "I know di country very well, I get a lot of family dia, and I dey very interested for wetin dey hapun dia," she tok. "But home na wia my family dey now." On dis issue of renewing her passport, she say: "I no dey identify wit am (she mean di Nigerian passport). Most of my life na for UK and I no tink say I need am." She add say: "I be Nigerian through my ancestors, by birth, even though dem no born me dia, because of my parents... but by identity, not really." Badenoch say wen she visit di country wen her father die, she bin need to get visa, according to her, di process "bin get as e bi". She say her early experiences for Nigeria shape her political outlook, including "why I no like socialism". As a child, "I remember say I no feel like say I belong dia", she tok as she add say "wen I come back to di UK for 1996, I feel say: dis na home". Di Tory leader add put say di reason she bin return back to UK na "a very sad one". "My parents bin reason am say: 'No future for you for dis country'." She say she neva experience racial issue for UK "in any meaningful form", she add say: "I know say I dey go place wia I go look different to everybody, and I no tink say e dey odd. "Wetin I find interesting na say di pipo no treat me differently, and na why I dey quick to defend di UK whenever di issue of racism come up." At di end of last year, some pipo bin criticise Badenoch sake of wetin she tok say she bin grow up in fear and insecurity for Nigeria during di time wen di kontri bin dey face serious corruption issues. Di country vice-president Kashim Shettima respond say im govment dey "proud" of Badenoch "in spite of her efforts to attack her nation of origin". Tok-tok pesin for Badenoch bin reject di criticism.


Sky News
7 hours ago
- Sky News
Kemi Badenoch says she no longer identifies as Nigerian
Kemi Badenoch has said she does not see herself as Nigerian and no longer has a passport for the country she grew up in. The leader of the Conservative Party was born in the London suburb of Wimbledon but was raised in Lagos, Nigeria. When Nigeria's economy collapsed in the 1990s, Ms Badenoch, then aged 16, moved back to the UK to live with a family friend and continue her education. Speaking to former MP and television presenter Gyles Brandreth on the Rosebud podcast, Ms Badenoch said as most of her life has been in the UK, she "does not identify" as Nigerian. "I'm Nigerian through ancestry, by birth, despite not being born there because of my parents... but by identity I'm not really," the North West Essex MP said. "I have not renewed my Nigerian passport, I think, not since the early 2000s." Ms Badenoch added that her home is now where her family is, which includes her extended political family. On Nigeria, she said: "I know the country very well, I have a lot of family there, and I'm very interested in what happens there." "But home is where my now family is, and my now family is my children, it's my husband and my brother and his children, in-laws. The Conservative Party is very much part of my family - my extended family, I call it," she added. Ms Badenoch said on her return to Nigeria after her father, Femi, who was a GP with his own clinic, died, she faced a "big fandango" to get a visa. She also said her early experiences in Nigeria shaped her political outlook, including why she doesn't like socialism. "I remember never quite feeling that I belonged there," she added. Last year, Nigerian vice president Kashim Shettima accused Ms Badenoch of disparaging the country, adding that she has "every right to remove the Kemi from her name". The criticism came after Ms Badenoch spoke about her life and childhood in Nigeria during the Tory leadership race. A spokesperson for Ms Badenoch responded to Mr Shettima at the time, saying the Conservative leader was "not the PR for Nigeria".