logo
Wafcon 2024: Nigeria vs Tunisia match preview

Wafcon 2024: Nigeria vs Tunisia match preview

BBC News06-07-2025
Nigeria Super Falcons go start dia Women's Africa Cup of Nations campaign on Sunday.
Dem go face Tunisia for dia opening Group B match wey go shele for di Larbi Zaouli stadium, Casablanca.
Dis na di second time wey dem dey meet for di Women's Africa Cup of Nations.
Di only time dem bin meet before na for Wafcon 2008 wen dem play goalless draw, for Bata, Equatorial Guinea.
Nigeria Coach, Justin Madugu say "We dey prepare veri well and di girls dey respond positively ...we dey good to go!."
Coach Madugu add say dem need to show respect to evri team wey qualify for dis finals.
"We no dey take anybody forgranted sake of assumption say we don win all our previous games against nort African teams becos e go dey easy, no game dey easy" im conclude.
Super Falcons Captain Rasheedat Ajibade say "evritin dey go well, di backroom staff dey make sure say dem do evritin to make di team respond positively, we dey do evritin to make sure say we perform well for all our games".
Head coach of Tunisia Kamel Saada say "Nigeria get good players and Tunisia get good team even though dem no dey experienced. but we fit start well against Nigeria. Nigeria na favourite but as far say we [Tunisia] qualify we fit get sometin out.
Match Facts
Nigeria
According to Caf data, Nigeria don play 61 matches for Wafcon finals, dem win 45—more dan any oda team. Dia record include 9 draws and 7 defeats.
Nigeria na di highest scorer for di tournament history wit176 goals for 61 matches, wit di average of 2.89 goals per game and dem concede only 28.
Dia record for Wafcon opening matches na eight wins , two draws and two losses for di 12 games wey dem bin don play.
Dia biggest opening-game win na 8-0 victory against host Morocco for 1998.
Nigeria have bin score 40 goals across dia 12 tournament openers and concede 8— and six na for dia last five opening games.
Na only one time don don fail to score for dia opening match, and na1-0 dem lose to South Africa for 2018.
Nigeria neva lose any of dia opening games across dia first 10 appearances (W8 D2), but dem bin lose dia opening match for di last two tournaments—1-0 and 2-1 defeat to South Africa for 2018 and 2022.
Before dem lose dem bin win four straight openers (2010–2016).
Tunisia
For Tunisia dia record for opening matches na one win and one loss out of two games.
Dem bin lose 2-1 to South Africa for dia 2008 opener. Dia only Wafcon win na for dia 2022 opening match wey dem beat Togo 4-1.
Dem no score for dia last four finals matches and na 372 minutes e be in total witout a goal.
Tunisia bin keep two clean sheets for eight final games—both against West African opponents (Nigeria for 2008, Senegal for 2022).
Dia only group-stage draw na di 0-0 result against Nigeria for 2008.
Live match commentary go start by 4pm Nigerian time
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Tinubu shower victorious Super Falcon players wit money, house and national awards
Tinubu shower victorious Super Falcon players wit money, house and national awards

BBC News

time11 hours ago

  • BBC News

Tinubu shower victorious Super Falcon players wit money, house and national awards

President Bola Ahmed Tinubu don shower di Super Falcons of Nigeria wit plenty money, houses and national honours for winning di 2024 Women Africa Cup of Nations trophy. Di President receive di players and dia technical crew for di Aso Rock Presidential Villa on Monday evening. For di ceremony, di Super Falcons captain Rashedat Ajibade present di Wafcon trophy to Tinubu, and goalkeeper Chiamaka Nnadozie also present her golden glove award for di best goalkeeper of di tournament. President Tinubu narrate how e bin no wan watch di final match bicos tension bin hold am, but e praise di girls for "making Nigerians very proud". "On behalf of a grateful nation, I hereby confer di players and di 11-man technical committee wit di National honour of Officer of the Order of the Niger (OON)," Tinubu tok. "Additionally, I hereby direct di allocation of one three-bedroom apartment to each of di players and di technical crew in our Renewed Hope Housing Estate. "Lastly, I also announce di cash award of di naira equivalent of $100,000 each to di 24 players, and di equivalent of $50,000 each to di 11-man technical team." Also for di event, di Chairman of di Nigeria Guvnors Forum and di Govnor of Kwara State, Abdulrazaq Abdulrahman, also announce a donation of N10 million each to di players and dia coaching crew on behalf of di NGF.

Nigeria Super Falcons shine for Wafcon as dem gbab three awards and $1m prize money
Nigeria Super Falcons shine for Wafcon as dem gbab three awards and $1m prize money

BBC News

time2 days ago

  • BBC News

Nigeria Super Falcons shine for Wafcon as dem gbab three awards and $1m prize money

Nigeria Super Falcons shine for di 2024 Women's Africa Cup of Nations as dem achieve di mission X. Dem win di continental title for di tenth time plus di $1 million prize money (1.5 billion naira) On Saturday night, di Super Falcons of Nigeria beat di host kontri Morocco 3-2 for di final game for di Olympic Stadium for Rabat, Morocco. As di game finally end on Saturday night, di Nigerian team no just lift up di trophy for di tenth time but dem also win three out of four six awards. Nigeria as di winning nation go also walk away wit, $1 million prize money. Who win and wetin dem win? Rashidat Ajibade, Nigeria captain win di Best Player of di tournament. Super Falcons goalkeeper Chiamaka Nnadozie also win di Best Goalkeeper Award for di tournament. Justine Madugu win Coach of di Tournament afta e guide di his team win di trophy wit di record of winning five match, scoring di highest number of goals and finishing wit only one draw during di tournament. Esther Okoronkwo win title of di Woman of di match for di final game against Morocco. Moroccan captain, Ghizlane Chebbak win di Golden Boot at di tournament, dis na di third time she go win di title. Di Banyana Banyana of South-Africa, win di Fair Play Award wit total of 510 points at di tournament. How much Nigeria team and odas go win? For dis just concluded CAF-WAFCON, di winning nation, Nigeria go walk away wit $1,000,000 as di prize money Second place - Morocco go walk away wit $500,000 Third place -Ghana go walk away wit $350,000 Fourth place - South-Africa team go walk away wit $300,000 Quarter-finalists go walk away wit $200,000 each Third in Group Stage go walk away wit $150,000 Fourth in Group go walk away wit $125,000 each Rasheedat Ajibade- Wafcon Best Player Award Rasheedat Ajibade na di best player of di Women Africa Cup of Nations (WAFCON) tournament afta Nigeria win against Morocco 3-2 on Saturday night. Di 25-year-old Atletico Madrid player contribute wit one goal and two assists during di tournament, but her overall performance during di matches na im make Nigeria win di game. Rasheedat don win dis title three consecutive time against Botswana, Zambia, and South Africa. In 2022, she bin win di highest goalscorer at WAFCON, showing her leadership qualities at di Morocco tournament. Chiamaka Nnadozie- Wafcon Best Goalkeeper Award Chiamaka Nnadozie na di official winner of Best Goalkeeper of di TotalEnergies CAF Women's Africa Cup of Nations 2024. Di twenty-three year old, Nnadozie show her skills for di field wit her fast flexible ability to catch any ball wey come close to di goalpost. Afta series of outstanding performance during di tournament she win di finest goalkeepers in African women's football. Justin Madugu- Wafcon Coach of di Tournament Award Justin Madugu officially win di Coach of di Tournament at di 2024 CAF TotalEnergies Women's Africa Cup of Nations (WAFCON). Di 61-year-old na local coach from Adamawa, e guide di female team wit im own experience to win di 2024 WAFCON game. Ghizlane Chebbak- Wafcon Golden Boot Award Ghizlane Chebbak for di third time win di Golden Boot title at di TotalEnergies CAF Women's Africa Cup of Nations (WAFCON) 2024. Di Moroccan captain, na di top scorer during di tournament. Chebbak continue to follow her papa foot steps, Larbi Chebbak, 1976 Africa Cup of Nations winner wit Morocco. Chebbak no dey waste time on di field, she show she dominance spirit during di game against Zambia, delivering good field performance. Also, within 13 minutes she pick di ball and score against Nigeria at di finals. Banyana Banyana of South-Africa- Wafcon Fair Play Award Banyana Banyana of South-Africa fail to retain dia continental title, but dem leave di competitio winning di Fair Play Award wit total of 510 points award base on di Technical Study Group criteria. Banyana Banyana start di tournament winning against Ghana 2-0, but di Ghanaian team come back to win against dem at di Semi-Final to win South Africans.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store