
US knack sanctions ontop Sudan say dem use chemical weapons for dia war
US exports to di kontri go dey restricted and financial borrowing limits go dey in place from 6 June, statement from tok-tok pesin Tammy Bruce read.
In response a Sudanese govment tok-tok pesin strongly condemn di move by Washington, describe am as a "deliberate distortion of facts concerning di situation in Sudan".
Both di Sudanese military and di paramilitary group di RSF don dey accused of war crimes during di conflict before now.
More dan150,000 pipo don die during di conflict, wey start two years ago wen Sudan army and di RSF begin one brutal struggle for power.
In recent months, Sudan military don recapture di capital of Khartoum, but fight dey kotinu for anoda place.
No detail dey about which chemical weapons di US say dem find, but di New York Times bin report in January say Sudan bin use chlorine gas on two occasions, wey cause different painful and damaging effects and fit dey fatal.
Dis, dem tok say bin don dey for remote areas wey dem no give dia names. Dem neva share share any visual evidence so far as proof of di weapons as e don dey used in di current war in Sudan.
"Di United States call on di govment of Sudan to cease all chemical weapons use and uphold im obligations under di CWC," di statement read, referring to di Chemical Weapons Convention under which signatories don commit to destroy dia stockpiles of di weapons.
Nearly evri kontri in di world - including Sudan - don agree to di CWC, apart from Egypt, North Korea and South Sudan according to di Arms Control Association, a US-based non-partisan membership organisation. Israel don sign di agreement but no ratify im signature, dis mean say dem neva legally confam dia involvement in di treaty, di ACA add.
"Di United States remain fully committed to hold to account those wey dey responsible for di contribution to chemical weapons proliferation," Bruce add.
Dis no be di first time wey di US don impose sanctions in Sudan. In January, dem knack leaders of both parties wey dey di konflict wit sanctions.
Sudan military leader Abdel Fattah al-Burhan bin chop accuse say e dey "destabilise Sudan and undermine di goal of a democratic transition" by di US, wey di kontri foreign ministry condemn as "strange and troubling".
Meanwhile, di head of di RSF Mohammed Hamdan Daglo, wey also dey known as Hemedti, dey determined to get perpetrated genocide in di kontri by former secretary of state Antony Blinken. Di RSF don deny dis charges.
Di rival forces don dey struggle for power for di past two years, displace around 12 million pipo and leave 25 million to need food aid, more dan double di population of London.
New sanctions go get small effect on di kontri sake of dis prior measures, according to di AFP news agency.
Dis latest US move dey come as tensions over di alleged involvement of di United Arab Emirates in di conflict.
Di UAE and Sudan bin don maintain diplomatic ties until earlier dia month wen di Sudanese govment allege say di UAE bin provide arms to di RSF, allegation wey UAE deny.
Following US President Donald Trump warm reception in di Gulf state last week, Democrats in Congress dey try to block di sale of arms from di US to di UAE in part sake of im alleged involvement in di conflict.
One Sudanese diplomatic source bin tell news agency Reuters say di US don impose di new sanctions "to distract from di recent campaign in Congress against di UAE".
Earlier dis month, one top UN court bin reject Sudan bid to sue di UAE for genocide.
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


BBC News
2 hours ago
- BBC News
Who be di candidates wey dey run for Cameroon election as Elecam disqualify Maurice Kamto
Cameroon Electoral Commission (ELECAM) don exclude Cameroon opposition leader Maurice Kamto from di list of candidates wey go contest for di October 12 presidential election. According to di list wey di kontri electoral body release on Saturday, 26 July, dem only approve 13 out of di 83 candidates wey declare dia intention to run. E neva dey clear why dem remove Kamto from di list, but di decision bin come afta e announce say im dey comot di Cameroon Renaissance Movement (CRM) party to join anoda party wey endorse am as candidate. Bicos di CRM party no fit endorse candidate sake of say dem no get any elected representatives for parliament or local councils, e decide to join MANIDEM party, wey get local representation. Who dey di list? 92-year-old Cameroon President Paul Biya dey part of di candidates wey make di list. Im former allies, Issa Tchiroma Bakary and Bello Bouba Maigari wey come from di vote-rich northern parts of di kontri also make di list. Popular anti-corruption lawyer Akere Muna, Social Democratic Front (SDF) party leader Joshua Osih, lawmaker Cabral Libii also dey among di candidates wey go contest for di kontri top job. Meanwhile, di firebrand mayor Patricia Tomaino Ndam Njoya na di only female candidate on di list. Ahead of di polls, critics don argue say plan bin dey to exclude Maurice Kamto wey come second for di 2018 presidential polls make e no challenge Oga Biya for dis year election. Oga Biya wey pipo reason say na di favourite to win for di October election bin reject calls to step down, as e say im still get a lot to offer Cameroonians, even though e don dey for power for nearly 43 years. Aspirants wey dey para sake of say dem dey disqualified from di presidential race get two days to file petition for di constitutional council within two days.


Reuters
4 hours ago
- Reuters
Cameroon elections body rejects candidacy of president's main rival
YAOUNDE, July 26 (Reuters) - Cameroon's electoral commission has rejected the candidacy of Maurice Kamto, the main rival to President Paul Biya, in an upcoming presidential election, raising the risks of protests and the likelihood of another win for the incumbent. The chief of the electoral commission, ELECAM, announced the decision in a press conference on Saturday when he read out a list of 13 approved candidates which did not include Kamto. No reasons were given. Those not listed have two days to appeal. Biya, 92, has been in power for 43 years and is the world's oldest-serving head of state. He announced his intention earlier this month to seek re-election in the October 12 vote. Kamto had come in second place with 14% of the vote in the last election in 2018, which Biya won by a landslide amid allegations of fraud. "In case of the rejection of certain candidates in this election, it is possible there will be protests in the centre of Yaounde and near the seat of ELECAM," the United Nations Department of Safety and Security said in a statement on Friday.


Reuters
4 hours ago
- Reuters
Central African Republic's Touadera announces bid for third term
BANGUI, July 26 (Reuters) - Central African Republic's President Faustin-Archange Touadera said on Saturday he will run for a third term later this year, seeking to extend his rule into a second decade after scrapping term limits in 2023. "Many of you have asked for me, and my answer is yes. I am your candidate for the presidential election of December 2025," the 68-year-old said at a meeting of his party, the United Hearts Movement, in the capital Bangui. "We will continue the work of rebuilding our country." Since taking office in 2016, Touadera has enlisted outside forces to stay in power amid a persistent civil conflict, including mercenaries from Russia's Wagner militia, who intervened in 2018 on the side of the government. Landlocked Central African Republic, roughly the size of France and with a population of around 5.5 million, is deeply impoverished despite being rich in resources including gold, diamonds and timber. It has witnessed waves of instability, including coups and rebellions, since independence from France in 1960. Touadera won a second term in 2020, though militants including the Coalition of Patriots for Change (CPC) have fought to overturn that result. The army, backed by United Nations peacekeepers and Russian and Rwandan troops, has been fighting the group for years. Touadera's current term was supposed to be his last, but in 2023 the country held a constitutional referendum that abolished the two-term limit and extended the presidential mandate from five to seven years. Opposition parties and civil society groups have said the new constitution, which was backed by more than 95% of voters, could allow Touadera to stay in power for life. The exact date of the December vote has not been announced.