logo
Wafcon 2024: Some first-timers wey fit help Nigeria Super Falcons sustain dia legacy

Wafcon 2024: Some first-timers wey fit help Nigeria Super Falcons sustain dia legacy

BBC News05-07-2025
Na few hours remain for di 2024 Women's Africa Cup of Nations [Wafcon] to start. Di opening ceremony go happun for di Olympic Stadium for Rabat.
Di opening match na host Morocco vs Zambia.
But for di Super Falcons of Nigeria, na less dan one day to dia opening match.
Di Super Falcons na one of di strongest sides for dis tournament. In fact, dem be di most decorated sake of say dem bin don win di trophy nine times. Now dem dey compete to win dia 10th title.
No women's team for Africa don come near dis achievement, na why Head Coach of di team Justin Madugu tell Nigerians say dem dey do evritin to make sure say di team maintain di confidence wey dem get ova di years.
"We dey do evritin on our part to make sure say we sustain di confidence wey Nigerians don give us, we go try as much as possible to meet una expectations, make una kontinu to trust and support di team."
Join Pidgin WhatsApp Channel for more tori on Wafcon 2024.
Coach Justin Madugu take ova from American Coach Randy Waldrum wey bin dey lead di team from 2020 till September 2024.
As Madugu don come now, im fit help Super Falcons overcome dia shortcomings?
Wetin be di shortcomings of di Super Falcons?
Some pipo go still ask wetin be di shortcomings of a team wey dey always represent for women's football for Africa and nobody don beat dia record till now.
Di answer be say even though dis team dey shine well-well according to history, dem neva too perform well in recent years.
Di last time wey dem win dis Wafcon trophy na six years ago, 2018 wen dem beat South Africa [4-3] on penalties for Accra Ghana.
Wen former Coach Randy Waldrum bin take over for 2020, expectations bin no too high sake of say di man na University student coach and im bin dey do di Super Falcons job side by side wit im oda work.
Randy Waldrum bin no to dey steady wit di team and some women's football pundits bin tok say na one of dis distractions wey di team bin get.
Randy Waldrum manage carry dem finish fourth for di 2022 edition, na Zambia beat dem 1-0 for di third place match for Morocco.
Now wey Justin Madugu don take charge of di team, Nigerians believe say im go do well.
Nigeria dey Group B wit Tunisia, Algeria, Botswana, Nigerians believe say di kontri go qualify from dis group.
Some oda pipo dey argue say host kontri Morocco fit win sake of di way dia women football dey grow and di kain players wey dem get.
See di complete Wafcon 2024 squad and di ogbonge players wey dey dis tournament.
Who be di first timers and wetin dem fit do
Di Nigeria squad list for di 2024 Wafcon get a combination of both old and young players.
And on Friday, di players get dia official jersey numbers for di tournament.
Some of di Wafcon first-timers na homebased players from di Nigeria Women Premier League [NWPL].
Miracle Usani - She be defender wit Edo Queens. For 2022 she bin win bronze medal for di U17 Women's World Cup.
Di Confederation of African Football [Caf] bin also name her for di Women's Champions League Best XI [Eleven]
She win di West Africa Football Union [Wafu B] Women Champions League qualifier last season for Ivory Coast.
Miracle wey dey 18 years na one of di most promising defensive talents for Nigeria.
Dem fit add value to di team and dem go try to show say dem no come dis tournament to play, some of dem na:
Racheal Onachukwu - Na Goalkeeper wey dey play for Nasarawa Amazons. She be dia number one goalkeeper and Sikiratu Isah of Nasarawa Amazons too go play dia first Wafcon.
Oda players to watch na Shikurat Oladipo wey come from FC Robo Queens for Nigeria move to AS Roma Ladies.
Experienced hands
Di Wafcon team get plenti players wey don win di title bifor, dis players don play for di higest level of international footballl.
Di likes of Francesca Ordega wey dey currently play for Ittihad Ladies Club, Saudi Arabia.
Osinachi Ohale don dey play for di national team for ova 10 years, she bin start wit U – 20 for 2010.
She be part of di team wey bin win in di title 4 times back to back.
Tochukwu Oluehi na di former number one goalkeeper for Super Falcon bifor Chiamaka take ova. Di former Rivers Angels goalkeeper still dey play professional football. She aslo get Wafcon titles to her name.
Asisat Oshoala na di most decorated Women's Footballer for Africa. She don win multiple Wafcon titles and also Caf Women's Player of di Year a record six times.
Di question na if di experience wey dis players get go pay-off dis time.
Na only time go tell if dia experiences fit help Nigeria win dia 10th title.
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

AfroBasket 2025: Nigeria sama Mali wotowoto for historic fifth back to back title and 7th overall
AfroBasket 2025: Nigeria sama Mali wotowoto for historic fifth back to back title and 7th overall

BBC News

time4 hours ago

  • BBC News

AfroBasket 2025: Nigeria sama Mali wotowoto for historic fifth back to back title and 7th overall

Nigeria women basketball team, D'Tigress don win dia seventh African basketball title. Dem sama Mali to win di title back to back five times. Dis final wey dem win, repeat di 2021 AfroBasket final wen dem bin face Mali too. Coach Rena Wakama wey bin win di trophy for 2023 and also set record as di first female coach to win di title bin tell BBC Pidgin say she bin don always dream to be coach and to win trophies. Nigeria President Bola Tinubu bin tell D'Tigress say dem don bring honour to Nigeria wit dia "discipline, focus and team spirit" for di 2025 Women's AfroBasket afta dem beat Senegal for di semi-final. Di president praise D'Tigress for inside statement afta di team qualify for dia fifth straight AfroBasket final. Meanwhile former Vice president Atiku Abubakar also congratulate di team too. ''Congratulations to D'Tigress, Nigeria senior women basketball team for reaching di finals of di 2025 FIBA Women's AfroBasket.'' On Saturday, Nigeria defeat Senegal 75-68 for di semi-final of di competition wey dey happun for Ivory Coast. Wit dis win Nigeria don secure automatic slot to play for di 2026 FIBA Women World Cup for Berlin. for di third place match, first timers South Sudan shock 11-time African Champions, Senegal 66-65 to win bronze. South Sudan also qualify for di 2026 World Cup qualifiers and 2027 AfroBasket Championship.

Lookman accuses Atalanta of 'broken promises'
Lookman accuses Atalanta of 'broken promises'

BBC News

time9 hours ago

  • BBC News

Lookman accuses Atalanta of 'broken promises'

Nigeria winger Ademola Lookman says he has handed in a transfer request at Atalanta after accusing the club of "breaking promises" to 27-year-old, a reported target for Serie A rivals Inter Milan, said he had reached an agreement with the club's board that he could leave if a "fair" offer arrived this the England-born winger says Atalanta have reneged on that promise after "receiving an offer in alignment to what I believe had been discussed"."I feel I have no choice but to speak out for what I believe is right and I feel that enough is enough," Lookman wrote on social media."I can confirm I have now handed in a formal transfer request." Lookman said Atalanta were "blocking the opportunity" of him leaving the club "for reasons I do not understand". The Nigeria international joined Atalanta from RB Leipzig in scored his first career hat-trick in the 2024 Europa League final victory against Bayer Leverkusen in has scored 52 goals in 117 appearances for the Italian side. Atalanta have been contacted for comment.

PSG defender Achraf Hakimi could face '15 years in prison' as prosecutors 'seek trial for alleged rape after years-long investigation'
PSG defender Achraf Hakimi could face '15 years in prison' as prosecutors 'seek trial for alleged rape after years-long investigation'

Daily Mail​

time2 days ago

  • Daily Mail​

PSG defender Achraf Hakimi could face '15 years in prison' as prosecutors 'seek trial for alleged rape after years-long investigation'

Achraf Hakimi could face up to 15 years in prison if convicted over an allegation of rape, after prosecutors in France formally requested that the Paris Saint-Germain and Morocco international be sent for trial before a criminal court. The request, signed on August 1 by the Nanterre prosecutor's office, marks the latest development in a judicial investigation that has spanned more than two years. A final decision on whether the case goes to trial now rests with the investigating judge, who can either approve or dismiss the recommendation. The case stems from an alleged incident on the night of February 25, 2023, at Hakimi's home in Boulogne-Billancourt, a suburb west of Paris. A 24-year-old woman claims she was raped after being invited to the player's residence. She told police that the two had begun exchanging messages on Instagram in January and that Hakimi arranged for a car to bring her to his home. Once there, she alleges he began kissing and touching her without consent and, despite her protests, forced her to engage in sexual acts. She says she eventually managed to push him away and left, later messaging a friend for help. The woman reported the alleged rape to police the following day, although she did not initially file a formal complaint. Messages she sent to friends about the incident were later provided to investigators. On March 3, 2023, Hakimi was placed under formal investigation — the French equivalent of being charged. The allegation against Hakimi, which he denies, was made in 2023. He has continued playing for PSG since then and was part of the team that won the UEFA Champions League in May According to Le Parisien, the final indictment request signals that prosecutors believe there is enough evidence for the case to go to trial, though it does not constitute a finding of guilt. Hakimi has denied any wrongdoing throughout the investigation and maintains the encounter was consensual. He has continued to play for PSG and the Moroccan national team in the meantime. His lawyer, Fanny Colin, described the prosecution's request as 'incomprehensible and senseless in light of the evidence in the case.' She said the proceedings had already highlighted contradictions in the accuser's testimony, particularly in psychological assessments. 'Achraf Hakimi and I remain as calm as when the proceedings began,' she said. 'If these requests were to be followed, we would obviously pursue all avenues of appeal.' The alleged victim's lawyer, Rachel-Flore Pardo, told Le Parisien her client had received this week's development with 'immense relief', viewing it as a sign the justice system is taking her claims seriously. PSG have not commented extensively on the case but have stood by the player, citing 'personal reasons' when he missed training sessions during sensitive phases of the investigation. The club has said it continues to trust the legal process. The investigating judge is expected to decide in the coming weeks whether Hakimi will stand trial.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store