logo
#

Latest news with #AdamawaState

How goment fit reduce di impact of flood for Nigeria?
How goment fit reduce di impact of flood for Nigeria?

BBC News

time7 hours ago

  • Politics
  • BBC News

How goment fit reduce di impact of flood for Nigeria?

Recently Nigeria don experience floods for some part of di kontri wey claim lives and properties. Report wey come from Adamawa State for Northern Nigeria tok say some pipo don die and many odas wunjure afta heavy flood sweep several communities for Yola North and Yola South Local Govment Areas of di state. Di heavy rain start bifor day break and kontinu reach Sunday morning, and e cause serious wahala for di affected areas. Places like Shagari Low Cost, Sabon Pegi, and Modire Yolde Pate for Yola South LGA suffer worst from di rain wey cause flood wey destroy pipo property and displace families. Di Adamawa State Police Command, for press statement, tok say dem don join hand wit sojas from 23 Brigade, Yola, and dem rush go di affected areas to support di community and help people wey dey suffer. How eva Governor Ahmadu Umaru Fintiri don defend wetin im goment do during di flood wahala. E beg make pipo focus on helping each oda instead of blaming goment wen disaster happun. For one statement wey e post for im Facebook page on Sunday, Governor Fintiri answer pipo wey dey criticize how di state handle di flood issue. E tokk say di goment no sit down dey look. "We dey on ground, my Deputy Governor Prof Kaletapwa Farauta and oda pipo dey field bicos we believe in action" e add. Di govnor also tok about di Chochi project wey don tey wey pipo dey tok say e go help stop flood for di state. "As for di Chochi project wey dem abandon since well, history go judge. No be eviri legacy dey age well." E send condolence to families wey lose loved ones and pray for people wey flood affect. "My heart dey with di families wey lose person and all di victims wey this flood touch." Recent flood incidents MAY 2025 - Di recent disaster for Nigeria wey claim many lives and properties na for Mokwa local goment area wey dey for Niger state for northern Nigeria. Reports from authorities for Nigeria tok say more than 200 die while dem still say ova 300 pipo don disappear during di flood wey happun for May 29. Di flood displace over 3,000 pipo in addition di floods wash away houses and bridges for di state. SEPTEMBER 2024 - While also last year Borno state for northern Eastern Nigeria experience one of di worst flood disaster for 30 years for di state. Di Borno flood also kill more dan 100 pipo and displace ova million pipo from dia homes according to wetin authorities tok for Nigeria. Di Nigerian Meteorological Agency (NiMet) recently don release one statement wey tok say floods go hit for some states for Nigeria say as raining season go soon reach im peak dis year. However many experts and authorities tink say floods wey dey happun for Nigeria na sake climate change wey dey happun for world. Di Niger state Emergency Management Agency (NSEMA) tok say di recent flood kasala wey happun for di state na sake of climate change and deforestation. Na acting director general for NSEMA tok dis one for Channel TV wey e describe Mokwa flood as some wey dem neva experience before. Hussaini tok say even though dem predict flood for some parts of Mokwa, pipo believe say Mokwa town dey safe, becos e no dey directly for front or back of any big dam or river. "I wan tell you say na becos of climate change, wahala wey dey happun for weather, and how pipo dey cut trees anyhow, places wey neva see flood before, don dey flood now" Hussaini tok. "Na why I gatz tok say di flood wey happun dis time, nobodi expect am and e no easy to predict." "Dis time around, we only predict flood for some villages for Mokwa Local Goment area, especially dos wey dey near River Niger" e add. How goment fit reduce flood kasala for Nigeria One safety expert Dr. Yusuf Idris Garba wey dey for Department of Environmental Management, for Bayero University, Kano. Tell BBC News Pidgin say many tins wey dey cos flood for Nigeria na climate change, lack of dams maintenance and lack of drainages for di kontri. "Majorly flooding for Nigeria wey bin dey happun na lack of drainages, lack of dam maintenance and ogbonge one na di climate change" "basically rampant or inappropriate waste disposal wey we dey get for our cities dey lead to choke up of our drainages wey dey cause flooding" Dr Garba add say lack of Environmental Impact Assessment (EIA) dey contribute di water to over flaw di dams wey suppose to hold di flooding. "Like for di one wey happen for Maiduguri last year, I think some of di recommendation of di experts wey conduct di EIA in di construction of di dam and post-construction. "most of di challenges, na that maintenance attitude wey dey part of di tins wey result into some of di problems we face for Borno." E also tok on how unpredicted rain dey cos wahala for Nigeria sake of climate change. "Environmentally due to di some changes wey we dey get, like climate change, because of that, our rainfall dey tend to be unpredictable sake of wetin we dey call climatic uncertainties. "Sometimes you go see say we dey experience very high intense rainfall within very short period of time wey later go cause floods especially for dos areas wey no get plenty drainage" Wetin be solution? Dr Garba highlight some important tins both goment and pipo gatz do wey fit reduce di effect of floods for Nigeria. "Goment gats to involve expert and consultants wey sabi EIA, wey dey go do dams maintenance for di kontri. "Anoda tin be say pipo gats to stop dey dispose waste anyhow especially for drainages, wey go eventually cause blockage and floods" im tok. E also tok say many pipo dey build houses for where suppose be water ways only. "You go see many pipo dey build houses where suppose be water ways or drainages for water to dey pass. Which dey make di flood disaster hit pipo well-well whenever strong rain fall." We don take measures dis year – River Basin Jigawa In effort to tackle flood disaster for Nigeria, River Basin wey dey for North west of Nigeria tok say all measures dey in place wey go fit help stop flood disaster dis year. Tok tok persin for River Basin Development Authority for Hadejia, Jigawa state, Salisu Baba Hamza tell BBC News Pidgin say dem don take necessary measures as dem take last year wey give dem positive result. "Recently we don supervise all our dams wey dey under our River Basin region, to see if dem get any issue. Our managing director don order us to release di water wey dey in di dams. "Befor raining season we dey always make sure our dams dey open 24/7 supply water to pipo wey dey farm, so dat wen rain season reach im peak we no go face any flood kasala" Hamza tok. Di PRO also tok about how dem dey try to remove one grass wey dem dey call 'Typer grass' wey dey block water from passing. Hamza add say "Our dams dey link to many rivers but di problem be say we get one grass wey we dey call Typer grass wey dey very strong, dis grass dey block water to pass, dis situation fit cause kasala.

Why Atiku lead di wave of resignations comot from PDP?
Why Atiku lead di wave of resignations comot from PDP?

BBC News

time17-07-2025

  • Politics
  • BBC News

Why Atiku lead di wave of resignations comot from PDP?

Former Vice President Atiku Abubakar don resign from Peoples Democratic Party (PDP), afta e be member of di political party since1998. Inside one letter wey Atiku write to di chairman of PDP of im ward, Jada Local Government Area of Adamawa State on July 14, e tok say im resignation na becos of "irreconcilable differences" and e go like resign wit immediate effect. E express im gratitude to di PDP for di platform wey allow am to serve as vice president between 1999 to 2007 and contest for presidency twice. "I write to formally resign my membership from di Peoples Democratic Party (PDP) wit immediate effect," e tok. "I go like to take dis opportunity to express my profound gratitude for di opportunities di party don give me. "Serving two full terms as Vice President of Nigeria and being Presidential candidate twice dis na one of di most significant chapters of my life. As a founding father of dis esteemed Party, indeed e dey heartbreaking for me to make dis decision." "However, I find am necessary to part ways due to di current trajectory di party don take, wey I believe diverge from di foundational principles we stand for. Na wit heavy heart I resign, recognizing di irreconcilable differences wey don emerge." "I wish di party and dia leadership all di best in di future. Thank you once again for di opportunities and support." However, many reactions don follow Atiku resignation from di party. Di tok-tok pesin to Atiku Abubakar, Paul Ibe tell Arise News say di letter na leaked document but e tok say becos some of di party members dey work wit di rulling party openly na im make im principal comot from di party. E tok say now wey Atiku don comot from di party e go tok about wetin be im next step tomorrow. "No be about any ambition or 2027 election. As tins stand now no opposition party for Nigeria, na only one party di All Progressives Congress. E be like bus stop, all di buses dey go one place Oshodi, na wetin APC don turn am into," Paul Ibe tok. "Wetin happun to democracy, if we no get framework for democratic engagement we no go get opportunity for good governance. Atiku wan give Nigerians a viable platform to confront APC." "Right now, as I dey folow you tok former vice president don turn in im resignation, as member of PDP. Wen we wake up tomorrow e go turn take im next step. I bin tink say dem go dey happy about am becos dem tok say na im di di problem of dia party." Meanwhile, PDP neva confam officially weda Atiku don leave di party but govnor Seyi Makinde of Oyo State, don hint say Atiku Abubakar don defect from di party. On Wednesday, Makinde tell tori pipo for Ondo state say PDP na institution, and any party member get di freedom to exit di party. "PDP na institution, and you get freedom of entrance and exit. Anyone wey dey hold PDP down, e betta for such individual to quit," e tok. "But one tin we must all realise be say players go come and go, governors go come and go, president go come and go but our state and kontri go remain." Oda keyholder stakeholders of PDP wey don comot from di party Also Dele Momodu, submit im resignation from di party on Thursday morning, e tok say some antidemocratic elements don seize PDP. Oga Momodu announce say im dey comot from di PDP to join di new coalition party, African Democratic Congress (ADC). "Our party don undeniably dey seize by antidemocratic elements, both from within and without, in broad daylight. "Diafore e dey honourable to give away di remain of di party to dem while di majority of us earnestly align wit di new coalition party, di African Democratic Congress (ADC)." In April, Delta state govnor, Sheriff Oborevwori comot from PDP to join APC, di news bin circulate for social media bifor di govnor and members of im cabinet declare say dem don join di ruling party. E neva dey clear but news don dey spread say Osun State govnor, Ademola Adeleke go soon defect from PDP to join anoda party to secure im seat for di 2026 govnorship election in Osun State. However, Iyiola Omisore wey be member of APC allege say Adeleke bon dey beg to join APC. Reaction from Nigerians and members of di rulling party Minister of Aviation Festus Keyamo, wey be key member of di ruling party, All Progressives Congress condemn Atiku decision to resign days afta di death of former President Muhammadu Buhari. "Your Excellency, whilst I acknowledge say e dey within your constitutional right to change political parties at any time you may wish, releasing your letter of resignation from di PDP during dis week of di mourning of our immediate past President, Muhammadu Buhari, na clearly attempt to draw di spotlight away from such occasion and direct am on yoursef," e tok. "E dey both morally and legally wrong to kontinu to use di Coat of Arms of di federal goment in your private or political communication wen you stop being functionary of di federal goment more dan 18 years ago. "Section 6 of di Flag and Coat of Arms Act, Cap. F30, Laws of di Federation of Nigeria, 2004 make dis offence." Atiku Abubakar political career under di PDP 78-eight-year-old, Atiku Abubakar serve under PDP as Nigeria vice president in 1999 to 2007, e contest as presidential candidate in 2019 and 2023 but e no win. Although Atiku don dump di PDP three times since im join, e leave for 2006 to go join Action Congress and 2014 to join APC wen dem bin newly form di party. E don try to become di president of Nigerian since 1993 under different political parties, Social Democratic Party (SDP), PDP, AC, and APC. Till today, Atiku remains one of Nigeria politician wey don contest for di seat of presidency but e neva win. Hopefully e fit win in di 2027 election, if im contest.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store