30-06-2025
Who be di APC acting national chairman Ali Bukar Dalori
Grassroot politician Ali Bukar Dalori don resume office as di Acting National Chairman of Nigeria ruling party di the All Progressives Congress (APC), afta di unexpected resignation of Abdullahi Umar Ganduje.
APC National Secretary, Ajibola Bashiru, formally present Oga Ganduje resignation letter to di National Working Committee (NWC) during dia meeting earlier.
Tori around di resignation of Ganduje wey be di former govnor of Kano state no clear as im or di APC neva release any official detail about di matter.
Oga Dalori resumption as APC acting chairman don draw attention as many Nigerians don begin ask about who im be.
Who be Ali Bukar Dalori?
Ali Bukar Dalori na grassroots politician from Borno State in Northeast Nigeria.
E be from Konduga local govment area of Borno state.
E be former Chairman of di APC for Borno State.
During im time as di chairmo, E bin dey reported say Oga Dalori bin strengthen di party structure for local level.
For 2022, Dalori bin also hold office as di Deputy National Chairman (North), position wey make am popular for di national level of di All Progressives Congress.
Bifor e become party chairman for state and national level, Ali Bukar Dalori bin start im political journey as a councillor.
E later become chairman of Konduga Local govment Area, wia e dey popular well-well. His dedication, especially during times of insecurity in the North-East, earned him broad respect.
Dem name Ali Bukar Dalori, wey be di deputy national chairman, as acting national chairman in line with Article 14 of di All Progressives Congress (APC) party constitution.
Di APC National Working Committee (NWC) for dia process, bin follow dia internal rules and appoint Dalori to avoid leadership vacancy within di party especially at dis kind time for political space.
As di most senior northern official for di party leadership, Dalori na di next in line by APC hierarchy.
Di party make di decision pending di time di National Executive Committee fill di position permanently.
As e resume office, Oga Dalori bin acknowledge former chairman, Abdullahi Ganduje contributions and tok thank you to am for im service.
Tok-tok wey dey go round within di party na say Ali Bukar Dalori appointment na to douse tension from di North-Central party members, sake of dia fear say dem dey sidelined wen Oga Ganduje wey be from di North-West become chairman against earlier zoning expectations.