Latest news with #BBCNewsPidgin


BBC News
2 hours ago
- Entertainment
- BBC News
'To Kill A Monkey come at di right time for my life'
Ogbonge Nollywood actress Stella Damasus say acting for di ogbonge movie 'To Kill A Monkey' come at di right time for her life. Damasus tok wen she siddon wit BBC News Pidgin to tok about di latest Kemi Adetiba film wey dey totori pipo and wey she act inside as Nosa - one of di main characters. "Evri choice wey you make get consequence. No mata di reason wey you take make am. If you put hand for dirty, dirty go follow you." Damasus tok as she share di lesson wey di movie dey try pass across. She say di big lesson from di film na to show how human beings take be and na evribodi get flaw, get problem and na wetin di storyline dey try show be dat. On how some pipo receive di movie sotay dem dey try relate Nosa role to who Damasus be for real life, Damasus say: "Na beg I dey beg, na feem. Becos I don see pipo say Nosa make you no enta mainland o. Anoda one say if una see wia dem dey flog Nosa, make una call me I must join." Howeva, to her, wetin pipo dey tok get anoda meaning as she see am as opportunity to prove say di pipo like di acting for di movie, and di cast do ogbonge work. "I like di fact say dem no fit tell di difference becos dat mean say we do veri good work, wey be say dem believe say na me be dat, but make dem also remember say na story we dey tell. "All di emotions, all di cry, all di triggers evritin, I don face am bifor I enta set. Becos if I enta set, I no fit let dose tins affect me. I go dey react to di characters but wen I don do dat part finish, I need to now come transition." Also, di opportunity to act di role according to Damasus, bin come at di time wey she tok say she bin wan come back Naija from America to do more tins. 'Marriage dey end' - Stella Damasus Di movie dey also come at a time wey Stella Damasus dey news sake of her marriage wey end. Damasus say she don move on. "Di role come at di right time wey I wan dey come naija now dey work. Afta evritin end for corner, I don alreadi move on, I get work wey I dey do." Di actress say she no dey allow wetin pipo dey tok to affect her and she no dey listen to dem becos she dey focus on hersef. "I don dey di game to understand say, no mata wetin hapun, pipo go get dia own opinion. If you notice, I no dey ansa anybody, I no dey fight anybody. "I dey tell pipo say my life, I dey too interesting. I neva understand mysef finish for di tins wey I get to do. I no get di time to begin tok." According to Damasus, marriage dey end and no be today. "Pipo dey marry, marriage dey end. Nobodi follow me dey inside bedroom or parlour. I no get di energy to begin address tins,. My own na say if you wan tok beta, come my front." Wen BBC News Pidgin ask Stella Damasus if she go marry again, she say she no dey look for. "Dat one na God hand e dey o. As I dey so, I dey okay. I no dey actively look for, I don born pikin. I no want, but na God na im go decide.


BBC News
a day ago
- Health
- BBC News
Eight ogbonge health benefits of watermelon
Watermelon na one fruit wey many pipo like well-well, especially for places wey dey hot. Pipo like am becos e get plenty water and e sweet for mouth. Watermelon na centuries old fruit wey dey juicy and sweet, and many pipo see am as perfect treat to quench thirst during serious heat. Wit bright red flesh and little seeds wey full di body, watermelon get plenty nutrients and antioxidants wey include vitamins A and C. For interview wit BBC News Pidgin, one dietitian, Sa'adutu Sulaiman for Kano state, northern Nigeria tok say "apart from say watermelon sweet, e get plenty beta health benefits." She add say all dis beta tins wey watermelon dey do na sake of di water wey full am and some special tins wey dey inside like lycopene (wey dey make am red) and citrulline. Watermelon na natural source of citrulline. Citrulline na amino acid wey fit support beta erections. Dietitian Sulaiman say watermelon na natural Viagra wey dey help men wey get low sexual performance, e dey increase blood flow to di penis, wey dey allow men to easily get erection wit arousal. "Research don show say citrulline wey dey watermelon fit help men wey get small wahala wit performance as e dey help blood flow well to di penis" she add. Health benefits of watermelon Dis na some of di health benefits wey dey inside watermelon according to Dietitian Sulaiman. Nutritional profile (per 100g of raw watermelon) Watermelon seeds dey good for eating? Health experts say watermelon seeds get less sugar and more fiber pass dia flesh. Di seed also contain citrulline. Watermelon seeds — dried or raw — dey rich in magnesium and folate, wey dey help your body work well and avoid disease. Seeds also get di types of fatty acids wey dey lower bad cholesterol for your blood and help you avoid heart attack and stroke. Research show say melons, in general, dey good for you, but we need more studies to understand how watermelon specifically affects your body.


BBC News
3 days ago
- Entertainment
- BBC News
'We don make statement wit SIN'
Filmmaker and entrepreneur Jim Iyke say im latest movie na di "boldest action thriller to ever come out from dis side". Iyke wey siddon wit BBC News Pidgin to tok about di new film - SIN - say, di film take three months to film for three different kontris and about 2,000 actors work for am on di set wit over 168 crew members. "Nobody go fit tok now say we no fit do am, e no be great feem but na statement and nobody go fit challenge our worth and skill anymore". Iyke tok, as e say e don make statement wit di film to showcase wetin Africa dey made of, to di world.


BBC News
15-07-2025
- Automotive
- BBC News
Meet di grandpa dem wey dey run car wash for Enugu Nigeria
Emeka Ede, now 70 years old bin enta car wash business wen e fin work many years ago but e no see and e decide to join di group of car wash for Enugu, Southeastern Nigeria. "I be 70 years now and 42 years for car wash and e make me to dey strong, if I no work for one day, two days, I no go get myself." Dis na true life tori of one old man wit im oda colleagues about how dem dey live dia life for many years. For dis car wash wey dey along Nkpokiti road for Enugu Nigeria, na old men dey work for dia and dem dey enjoy wetin dem dey do. BBC News Pidgin enta Enugu to meet and speak to dis men to know wetin dey build and fuel dia energy for di car wash business despite dia age. Dis group of older men wey dey ova 70 and 80 years come togeda to form Ochomma association of car wash. Dem say dem dey do di car wash business to keep fit and make money to fit feed dia families. I sidon for hours wit dis men to see how dem dey operate, how dem dey get customers and run dia jobs evri day. E dey surprising to find say dis men stand for long sake of say dem gatz hustle for customers wey dem go wash dia car. All thru our stay wit dem, dem no quarrel and nobodi abuse di oda - but dem gada dey work togeda and help each oda. Mr Emeka tok say im don spend 42 years for car wash business inside Enugu wia e join im oda mates to dey wash vehicles evriday. "We get law say if you see motor wey dey come, first to rush go be di one to wash di motor. And we no dey allow all dose small boys to come here," Mr Emeka tell me. E say di work dey make am fit and im dey take am as exercise for im bodi. Anoda memba of di carwash team na Mr Ferdinand Okoye wey be 81 years old. E surprise me to see pesin of im age to dey do di car wash business but e say im like am. "For this business ehn, pipo don tell me say how I like to dey wash car for dis age. I tell dem say well, I like am," Mr Okoye tok. For Mr Okoye, e fit wash up to three to four cars in one day and dat go fit put food for im table for di day. E dey sweet Mr Okoye for belle say di work dey make am fit and di only reason im no go come work any day na if e no well. "You know say na part of exercise wey we dey do. Na im make me like dis work." Dis car wash get about ova 20 old men wey dey work for dia, and according to dem, na means to make dia daily bread and also keep dia bodi fit.


BBC News
03-05-2025
- General
- BBC News
'All religions aim to establish relationship wit God' - Catholic priest wey turn African Traditional religion expert
Afta im spend 17 years as Catholic priest, Echezona Obiagbaosogu leave di priesthood for African Traditional Religion (ATR) at a time wen pipo dey tok more on di indigenous religion. Obiagbaosogu move don generate plenty tok-tok on social media as some describe am as bold and inspiring to dose wey fit dey nurse di same idea but dey fear to follow di road. E tell BBC News Pidgin say even wen im be priest, e don always do some rites of di African Traditional Religion, and add say im only continue to live im life as believer of God. "Shey switch bin dey? I don always live my life. Even as priest I don always do some rites of di African Traditional Religion. Even on cassock, I don always try to practise di much wey I fit. "Contradiction no dey anywia. So, switch no dey, I just continue to live my life as believer of God," e tok. Obiagbaosogu say all religions, as dem get dia symbolic elements of culture, dey aim to establish "relationship wit God, di Supreme reality". Obiagbaosogu no dey alone on dis path. At 45, Chekwube Okwunwendu don undergo profound spiritual transformation. Once a devout Catholic, now e don find fulfilment in ATR. Although dem born am into African Traditional Religion bifor im convert to Christianity, but e bin no imagine say one day im go take different path from Christianity. "I bin feel lost in Christianity. I bin get questions wey no one fit answer," Chekwube tell BBC News Pidgin. "Meanwhile, Christianity and Islam na imported religion for Africa. Africa get im own as Traditional Religion. So, e dey veri important for Africans to maintain dia own instead of to kill am. E say wen im begin to read about im ancestors spirituality, evritin make sense, and add say e finally feel at peace. Across Nigeria, more pipo dey rediscover dia indigenous spiritual heritage and dey break away from Christianity and Islam to embrace ATR. For some, na about rejecting colonial influences. For odas, na search for identity and spiritual authenticity. 'Pipo dey come in search of somtin wey dey deeper' Oluwo Olawole Olakunle, wey be Ifa priest for Lagos, southwest Nigeria, don notice increase in di number of young pipo wey dey renounce Christianity and Islam for ATR. "Pipo dey come in search of somtin wey dey deeper. And wetin dey deeper here na self-realisation. Wen pipo come into Isese (ATR), e dey give dem di opportunity to work di journey to self-realisation," e tok. "Sometimes, e fit be hardship. In di course of finding succour to dia lives, dem realise say dem don dey disconnected from dia source. River wey forget im source go definitely dry up. But some pipo just love ATR becos of wetin e dey offer." E say pipo now get access to genuine information and no too dey rely on Nollywood, wey e accuse say dey misrepresent ATR. Anoda Nigerian Ifa priest identified as Oluwo Jogbodo say all di pipo im don convert so far na Christians and Muslims. "And dem always tell me say e bin start wen dem begin question evritin. So, I think if more pipo start to question dia religion, dem go also convert," e tok. "Blindly following ideology na wetin allow Abrahamic religions to gain ground. Once pipo start to dey question am now, dem go see di light." Abisola Alawode, wey be Nigerian journalist and producer of one documentary titled Exploring African Spirituality, believe say na growing consciousness among young Nigerians dey drive di shift. "More Africans dey question di erasure of ATR and dem dey actively reclaim dia spiritual heritage," Alawode explain. "Di way dem dey see ATR for di media and public discourse don change a lot over di years. Dem bin demonise am bifor, but today, growing effort dey to reclaim and respect am." According to Alawode, social media don play important role for dis movement. "Platforms like Twitter, Facebook, and YouTube don give African Traditional Religion practitioners a voice. Dem dey use dis spaces to educate odas and dismantle stereotypes," Alawode add. Di legacy of Christianity and Islam for Africa To understand di present shift, e dey important to look at di past. Islam bin enter Nigeria through trade routes for di 11th century, and spread through di northern regions wit di rise of di Sokoto Caliphate for di 19th century. Christianity bin arrive for di 15th century wit Portuguese explorers, but na for di 19th century, wit di efforts of British missionaries, e get firm root. Dis religions bin gradually displace indigenous spiritual systems, and often label dem as primitive or satanic. As of 2015, di Pew Research Center bin report say Nigeria population na 50% Muslim and 48.1% Christian, wit around 2% wey dey adhere to oda or no religious affiliations. Additionally, many pipo blend indigenous animist beliefs or traditional practices wit Islam or Christianity. 'Religion wey neva go war on im own behalf' Renowned writer and Nobel Laureate Professor Wole Soyinka na advocate of African spirituality. E famously remove imsef from Christianity, and favour Orisa worship instead. E describe di religion of di Orisa (ATR) as "one of di few religions for di world wey neva go war on im own behalf, on im own basis, for di promotion of im ideas". "Na veri tolerant religion—di religion of di Orisa. And despite im reticence, e actually successfully cross di Atlantic in di hearts of di slaves, to di Caribbean, to Latin America, Brazil, Cuba, Colombia, Dominica, Puerto Rico, name am. Anywia di slaves go, dia religion survive in spite of veri harsh reprisals from di slave owners," Professor Soyinka tok for one viral interview. "Not only dat, dis religion bin dey so infectious sotey e syncretise wit Roman Catholic religion." Meanwhile, di renewed interest in ATR dey beyond religion—na about identity, culture, and history. As more Nigerians dey embrace dia indigenous beliefs, dem believe say dem no dey just reconnect wit dia ancestors but dey forge a new path wey dey honour di past while shaping di future. "Dis no be trend," Oluwo Olakunle tok. "Na self-realisation."