08-07-2025
Jamb put university admission cut off mark for 150
Nigeria goment don announce cut off marks for admission into Universities, Polytechnics and colleges across di kontri.
Minister of Education Dr Maruf Olatunji Alausa say di cut off marks for universities go be 150, Colleges of nursing go be 140, Polytechnics go be 100 while Colleges of Education go be 100.
Di minister make di announcement afta policy meeting wit Vice Chancellors, Rectors, Provosts and Joint Admission and Matriculation Board (Jamb) for Abuja Nigeria capital.
Di meeting agree say all admission processing must end by December 2025.
Di meeting also agree say if any school offer pesin admission, di candidate get maximum of four weeks to accept di admission or reject am, or di admission go dey forfeited.
Di minister for education also announce say henceforth admission age go be 16 as against di age 18 wey dem bin announce last year.
During Di meeting JAMB registrar Ishaq Oloyede announce say during dis year admission, candidate's admission document go carry dia score and dia rank for di general exam.
We dey update dis tori