logo
#

Latest news with #EKEDC

Lagos power outage - which areas e go affect and wetin you fit do about am
Lagos power outage - which areas e go affect and wetin you fit do about am

BBC News

time2 days ago

  • Business
  • BBC News

Lagos power outage - which areas e go affect and wetin you fit do about am

Di Nigerian Electricity Regulatory Commission, NERC and di Nigeria Independent System Operator, NISO don gree make di Transmission Company of Nigeria, TCN upgrade one of dia 30kV lines wheeling bulk power. Dem wan install Optical Ground Wire (OPGW) fibre cable for di Omotosho/Ikeja West 330kV transmission line. Dis na di places wey go dey affected from di 28th of July to di 21 of August from 8am to 5pm. Even Eko Electricity Distribution Company (EKEDC) say dia customers go experience irregular power supply sake of di maintenance work TCN wan carry out on di Omotosho – Ikeja West 330kV transmission line, but dem no tok dis exact areas wey go dey affected. So how pipo wan take deal wit di nine hours of no light evriday for a month. All in all, na money e go take to really accomodate all di tins wey fit sup sake of dis light outage. Wetin TCN wan do wey dey make dem power off Di Disco companies explain say di reason for di partial blackout na sake of scheduled maintenance wey di Transmission Company of Nigeria wan do di Omotosho-Ikeja West 330kv powerline, and di maintenance go affect di load shedding across dia networks. Di maintenance go involve upgrade of operations for Omotosho–Ikeja West 330kV transmission area, and dis na one important power transmission channel for Nigeria power grid system. Di line dey serve as key conduit between di Omotosho Power Station for Ondo State and Ikeja West, wey be major power transmission hub for Lagos State. Ikeja Electric and EKEDC don inform residents within dis coverage areas to expect load management measures throughout di maintenance period, wey fit affect residential, commercial, and industrial during working hours. For Lagos residents during di peak hour wen power supply go dey dem go need to schedule dia activities and business around di blackout.

Lagos go experience partial blackout for 25 days
Lagos go experience partial blackout for 25 days

BBC News

time4 days ago

  • Business
  • BBC News

Lagos go experience partial blackout for 25 days

Residents for some parts of Nigeria largest commercial city, Lagos state go experience partial power outage for 25 days, according to di state electricity distribution company. Di Ikeja Electric Plc announce on X say di Transmission Company of Nigeria (TCN) wan carry out repair work on Omotosho – Ikeja West 330kV transmission line, and dat go cause power cuts for di area from Monday, 28 July to 21 August, 2025 According to Ikeja Electric, di maintenance go cause partial power supply across some areas of di state during dis period. Di affected areas wey include Ojodu, Oke-Ira, Agidingbi, Omole Phase 1 & 2, Iju, Berger, Magodo (Phase 1 & 2), some parts of Ketu, Oregun, Ojota, some parts Agege, Ifako, Abule Egba, Ojo, Ikeja, Oshodi, Ayobo, Alimosho, Ogba, Alausa and Ejigbogo. Eko Electricity Distribution Company (EKEDC) also say dia customers go experience irregular power supply sake of di maintenance work TCN wan carry out on di Omotosho – Ikeja West 330kV transmission line from 28 July to 21 August, 2025, but dem no tok dis exact areas wey go dey affected. However, di company operations na for Lagos Island, Victoria Island, Lekki, Apapa, Festac and Surulere. Wetin be di reason for di expected blackout? Di Disco companies explain say di reason for di partial blackout na sake of scheduled maintenance wey di Transmission Company of Nigeria wan do di Omotosho-Ikeja West 330kv powerline, and di maintenance go affect di load shedding across dia networks. Di maintenance go involve upgrade of operations for Omotosho–Ikeja West 330kV transmission area, and dis na one important power transmission channel for Nigeria power grid system. Di line dey serve as key conduit between di Omotosho Power Station for Ondo State and Ikeja West, wey be major power transmission hub for Lagos State. Ikeja Electric and EKEDC don inform residents within dis coverage areas to expect load management measures throughout di maintenance period, wey fit affect residential, commercial, and industrial during working hours. For Lagos residents during di peak hour wen power supply go dey dem go need to schedule dia activities and business around di blackout. Wen and how long di power outage dey expected to last Di electricity distribution company say di maintenance go last for 25 days. E go start on Monday, 28 July and end on 21 August, 2025. Lagos residents go experience di blackout between 8:00am-5:00pm daily. Areas wey go dey affected by di blackout?

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store