logo
#

Latest news with #MondayOkpebholo

'Nigerians get freedom of movement within di kontri' - Nigerians tell Edo state govnor Okpebholo
'Nigerians get freedom of movement within di kontri' - Nigerians tell Edo state govnor Okpebholo

BBC News

time19-07-2025

  • Politics
  • BBC News

'Nigerians get freedom of movement within di kontri' - Nigerians tell Edo state govnor Okpebholo

Nigerians don begin react to viral video wey show as Edo state govnor Monday Okpebholo ban di Labour Party presidential candidate for di 2023 elections, Peter Obi from entering di state without security clearance. Inside di trending video, di Edo state govnor say make Obi no come di state without telling him, as im security no dey guaranteed. "I dey send direct message to am, new sheriff dey for town, e no fit come Edo make e no tell me, becos im security no go ever dey guaranteed. Whatever happun to am wen e dey Edo state, e go take am." Govnor Okpebholo also allege say di last time di former Anambra state govnor visit Edo state wen e donate 15 million naira to one nursing school, crisis happun afta e comot, wey lead to di death of three pipo. BBC Pidgin don reach out to di state police command to verify dis claim, but dem neva reply yet. Di govnor sama dis warning on Friday, 18 July for Uromi, Esan Northeast Local Government Area wen e dey receive some politicians wey decamp from di opposition Peoples Democratic Party (PDP) to di ruling All Progressives Congress (APC). Oga Peter Obi neva react to di comment wey govnor Okpebholo make. For 8 July, Peter Obi bin tweet on X about im visit to Philomena College of Nursing Sciences for Benin City, Edo State, wia e donate 15 million naira give dem to improve healthcare delivery. 'Obi na citizen wey get freedom of movement' However, plenty Nigerians wey include di PeterObi Obidient Media Centre don react to di govnor statement. For statement wey dem post on X, di Obidient Media Centre disagree wit wetin di Edo state govnor tok, as dem say Nigeria constitution guarantee di right of every Nigerian citizen to move freely and reside in any part of di kontri. Dem say dis no be di first time dis dey happun, as di govnor of Benue state bin issue similar threat against dia principal wen e visit di state for goodwill and charity. Di statement add say make Nigerians no see dis threat as small mata, as Nigeria belong to everybody, and no individual, no matter how highly placed, suppose try divide di kontri by inciting violence or wit dia words. "We wish to alert Nigerians plus di international community say make dem no take dis threats lightly. If anytin untoward happun to im Excellency Peter Obi, make Nigerians know wia to look. Dis governors na di chief security officers of dia respective states, and dia utterances carry weight – no be just in words, but in potential consequences." Di Interim tok-tok pesin for Africa Democratic Congress (ADC), Bolaji Abdullahi for im reaction say Peter Obi na free citizen and e no need di govnor clearance to visit Nigerians for dia own kontri. "Edo State na Nigerian State. Di govnor statement betray deep insecurity. Wen a Governor begin panic ova courtesy visits and modest donations, na clear sign say sometin dey deeply wrong somewhere. "Leaders wey don serve di pipo well no dey bother wen odas receive clap. Perhaps, di pipo wey dey celebrate PO simply dey remind di Edo state govnor di kind of leader e suppose be," Oga Abdullahi tok. Labour Party govnorship candidate for di 2024 election, Olumide Apata say, "Peter Obi no need anyone permission to visit Edo State or any oda State for dat matter. Not now, not ever." Di Edo state govnor comments dey come as reports say di Kaduna state police command don stop one rally wey supporters of Peter Obi dey plan in honour of im birthday for di state, as dem cite security concerns. For one statement on Saturday, 19 July, di police tok-tok pesin Mansir Hassan tok say di rally dey happun di same day one primary elections dey hold for di state, and e fit lead to gbasgbos and break down of law and order. "Intelligence information wey di command receive na say certain criminal elements dey plan to intrude and hijack di proposed rally, and use am as platform to cause disruption, incite violence, and disturb the prevailing public peace for di state." Di police warn say e go take necessary legal action against any individual or group wey violate di directive. Oda times state govnors don stop politicians from coming to dia state Dis no be di first time a state govnor go kick against di visit of a politician to a state without security clearance from di govnor. For April, di Kogi state goment bin ban rallies and public gatherings for di state, ahead of di homecoming ceremony of di suspended senator wey dey represent Kogi north-central Natasha Akpoti-Uduaghan to her constituency. Di state goment bin cite security breach as dem say di intelligence reports wey dem receive show say some pipo dey plan to "stage some violent rallies in di guise of political and religious agitations" for Kogi Central. Di commissioner of Information Kingsley Fanwo add say di state goment don direct say anybody wey wan enta di state wit convoy of security personnel must "obtain prior clearance from state commands of di deploying services. Benue state goment for April also say any high profile pesin wey wan visit di state must get clearance from di govnor, Hyacinth Alia. For one statement wey di Chief Press Secretary, Tersoo Kula, bin issue at di time, e say, "For anyone wey dey consider to visit Benue State without di knowledge or approval of di govnor, e dey important to reconsider, as dia safety and security no fit dey assured," Di statement further direct di individuals or organisations wey dey plan to visit Internally Displaced Persons (IDP) camps must obtain written clearance from di Benue State Emergency Management Agency (BSEMA). Although, di goment no mention names for di statement, but di directive bin draw immediate criticism from many wey believe say di target na di Labour Party 2023 presidential candidate, Peter Obi, wey bin dey plan humanitarian visit to IDP camps for di state.

Supreme Court set to deliver judgement on Edo State govnorship election
Supreme Court set to deliver judgement on Edo State govnorship election

BBC News

time10-07-2025

  • Politics
  • BBC News

Supreme Court set to deliver judgement on Edo State govnorship election

Di Supreme Court go deliver judgement dis Thursday on di Edo State govnorship election wey bin hapun for 21 September, 2024. Di mata na between Asue Ighodalo wey be candidate of Di Peoples Democratic Party (PDP) and Monday Okpebholo, candidate of di All Progressives Congress (APC), wey di Independent National Electoral Commission, Inec bin declare as winner of di election. Ighodalo bin come second for di election but e claim say Inec bin no comply wit di electoral rules and say dem deliberately favour di APC candidate. Di PDP candidate also allege say plenty cases of over voting bin hapun during di election and if dem remove dose votes, na im suppose be di winner of di election, no be Okpebholo. But Oga Asue Ighodalo bin lose di case for both di Edo State Governorship Election Petition Tribunal and di Court of Appeal, as di two courts confam Okpebholo as di winner of di election. Di two lower courts agree say PDP and dia candidate no provide enough evidence for court to prove say wuruwuru bin dey for di election, or say Inec bin no follow di electoral guideline. Dis na why Ighodalo carry di mata go Supreme Court wey be di highest court, asking dem to set aside di decisions of di tribunal and di Appeal Court, and to declare am winner of di govnorship election. We dey update dis tori...

Azura Power commissions two pivotal community projects in Orior-Osemwende, Edo State
Azura Power commissions two pivotal community projects in Orior-Osemwende, Edo State

Business Insider

time04-06-2025

  • Business
  • Business Insider

Azura Power commissions two pivotal community projects in Orior-Osemwende, Edo State

In yet another significant commitment to the socio-economic development of its host communities, Azura Power West Africa Limited (APWAL) on Wednesday, 28 May, 2025 inaugurated two pivotal projects in Orior-Osemwende Community, Benin City, Edo State: the reconstructed Orior Primary Health Centre and the 1.1km Orior Community Road, thereby scaling up access to qualitative healthcare and improved connectivity for the residents of the community. The two key projects executed through the "Power to Change" (PTC) initiative – the company's strategic Corporate & Social Responsibility vehicle – address the critical needs within the host community, the company stated. The Governor of Edo State, Senator Monday Okpebholo, who performed the formal commissioning of the projects, commended Azura Power West Africa Limited for its investment in initiatives that tangibly impact the lives and well-being of Nigerians, emphasising the benefits of partnership and collaboration between the government and the private sector toward accelerating the accomplishment of the Sustainable Development Goals (SDGs). The governor stated that Azura Power's sustained commitment to making a real difference in the lives of the residents of the Orior-Osemwende community was exemplary and worthy of emulation for other businesses. In his welcome speech, Managing Director, Azura Power West Africa Limited, Mr. Edu Okeke, disclosed that the two projects, culminating in a total cost of 1.66 billion Naira, were aimed to significantly enhance healthcare infrastructure by providing a modern and improved primary healthcare facility for the residents of its host communities - Orior-Osemwende, Ihovbor and Idunmwowina – and adjoining communities, as well as improve community connectivity by delivering vital road infrastructure to facilitate movement, access, and overall quality of life. 'For us at Azura Power West Africa Limited, the reconstructed Orior Primary Health Centre and the 1.1km Orior Community Road in Orior-Osemwende community not only exemplify APWAL's continued dedication to our host communities but also highlight the tangible impact of the 'Power to Change' programme in fostering sustainable development and empowering lives at the grassroots level,'' he stated. He said further that Azura Power's PTC programme was a positive example of how corporate entities can meaningfully contribute to the development of their host communities, showcasing a model of responsible corporate citizenship. Okeke expressed deep gratitude to Governor Okpebholo-led administration for providing an enabling environment for businesses to thrive, and noted that the governor's commitment to improved security, road and general infrastructure across the state would go a long way in attracting more investors into Edo State. 'The reconstructed primary health centre will directly improve healthcare access and outcomes for the residents of Orior-Osemwende. Similarly, the newly built community road will enhance connectivity, ease of movement, and overall quality of life for the community members, potentially impacting economic activities and social interactions. If we take our modest contribution to community development as examples of incentives to attract more investors, the impact will be more when it is done on a large scale,'' Okeke affirmed. He assured of Azura Power's long-term commitment to the socio-economic advancement of its host communities, stating, 'We will position the 'Power to Change' programme as a testament to this long-term vision of creating positive and lasting change, demonstrating that APWAL is a responsible and invested partner in the community's progress.''

Five key tins wey don happun since di Uromi killing
Five key tins wey don happun since di Uromi killing

BBC News

time31-03-2025

  • Politics
  • BBC News

Five key tins wey don happun since di Uromi killing

Edo state govnor Monday Okpebholo say dem don transfer di 14 suspects wey police arrest in connection wit di killing of travellers wey meet dia end for Uromi, one community for di state go Abuja, di kontri capital for further interrogations. Govnor Okpebholo wey give dis informate wen e pay condolence visit to di Kano state govnor Abba Yusuf and wit di families of di travellers on Monday, 31 March say more arrest go follow as investigation kontinu. E also pay condolence visit to di deputy president of di senate Barau Jibrin, and e give assurance say di perpetrators go face di full wrath of di law Last week, tori bin go viral of how one local vigilante group bin carry out violent mob action against one group of travellers dem allege say be kidnappers wey dey travel along Uromi-Obajana road for Edo state. Di Nigeria Police say di group bin dey travel inside one truck wen di vigilantes bin stop and search di truck. Dem see di travellers wey claim to be hunters in possession of 19 locally fabricated firearms. Di police say di vigilantes bin no dey satisfied wit di excuse say hunters go dey in possession of such number of arms, and conclude say dem be kidnappers, and dat result to di gruesome killings. Series of events don happun since then, wey include arrest and suspension. Dis na some of di key tins wey don happun. Tinubu condemn attack and call for full investigation Nigeria President Bola Tinubu bin give marching orders to security agencies to fish out those wey dey behind di killing of di travellers for Edo State. Di President describe di act as very despicable for statement. "Di President, wey express shock for di dastardly act on Thursday, direct Police and oda security agencies to carry out swift and thorough investigations and punish di suspected culprits". E add say jungle justice no get place for Nigeria, and all Nigerians get di freedom to move freely for any part of di kontri. Edo govnor suspend Security Chief, vigilante Di govnor order di immediate suspension of all illegal vigilante groups wey dey operate for di state. Di govnor also suspend di Commander of di Edo State Security Corps, Friday Ibadin. According to one statement wey di Secretary to di Edo State goment, Umar Ikhilor sign, e say di suspension na sake of di Uromi incident. "Di local vigilante group wey get hand for di gruesome killing of 27th March bin dey operate illegally as dem no dey registered wit Edo State Security Corps. "Dia actions no show di core values, character and principles of di Okpebholo administration, or di objectives of di corps as dem write am put for di Edo State Security Corps Governance Law." Arrest of 14 suspects As di mata dey hot, di Inspector-General of Police, Kayode Adeolu Egbetokun, say dem immediately deploy operatives for di Edo State Police Command go di affected community to restore law and order. E say dem don arrest 14, and don launch manhunt to arrest oda perpetrators wey dey involved for di mob action. Oga Egbetokun don also order di Deputy Inspector-General of Police in charge of di Force Criminal Investigation Department (FCID), DIG Sadiq Abubakar, to take ova di case and ensure a thorough, impartial, and expedited investigation. Okpebholo visit Kano govnor and families if victims On Monday, 31 March, di govnor bin pay condolence visits to di families of di victims for Kano state and to di state govnor Abba. Govnor Okpebholo assure di bereaved families and di pipo of Kano State say justice go dey served. For im tok during di visit, e describe di attack as unfortunate and repeat im commitment to ensuring say di perpetrators dey brought to justice. E say di first thing wey im do na to remove di corpses and arrange dem for proper burial. "I bin dey deeply touched wen I receive di news of di incident at night. By 4 a.m., I leave Abuja and rush go Uromi to meet wit di affected families. During my campaign, your pipo bin support me, and I stand wit you for dis time of grief. I extend my condolences to di pipo of Kano State and pray for di eternal rest of di victims' souls." E tell govnor Abba Yusuf. Di Edo state govnor also promise to support di affected families, and govnor Abba Yusuf, confam say e don fulfil di promise. Who be di pipo wey local vigilantes knack for Uromi Authorities neva give full details on who di travellers wey die for Uromi be. Earlier reports bin label dem as hunters, but subsequent reports from di police and di Edo state goment only identify dem as travellers. Di Kano state goment tok say di victims come from two local goments for di state. Edo state govnor say some of dem na from Bankure local goment area. Di kwesion on who dem really be still hang for air, dis na as cases of banditry, kidnapping and general insecurity still dey high for Nigeria.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store