logo
#

Latest news with #ObidientMovement

'Why I miss Buhari burial'
'Why I miss Buhari burial'

BBC News

time5 days ago

  • Politics
  • BBC News

'Why I miss Buhari burial'

Dem don bury former Nigeria president Muhammadu Buhari wey die on Sunday. Di state burial wey di Federal goment organise happun on Wednesday for Daura, Katsina state, Northwest Nigeria. Dis na a day afta dem declare public in honour of di former president. Many people including Nigeria President Bola Tinubu, leaders of foreign kontris and diplomats follow for di crowd of mourners wey land for Daura. Also, ogbonge political leaders – both from the ruling and opposition parties lead by former Vice President Atiku Abubakar also full for dia. But pesin wey many pipo notice im absence na Peter Obi, leader of di Obidient Movement. A group of young and energetic supporters of di opposition leader wey contest and pull crowd for di 2023 presidential election as a first timer. Many pipo bin dey wonder why Oga Peter Obi no show for di burial. Dis also generate many reactions for social media. Peter Obi tok why e miss Buhari burial Peter Obi na popular voice among young pipo for Nigerian wey don come to appreciate im economic lifestyle. Most times dem dey like to see am ontop national platforms and dem don begin ginger am again to contest di 2027 presidential election. Though e miss di former President burial, Peter Obi later join new set of mourners wey land for Daura. E join former Vice President Atiku, Nasir El-Rufai and oda opposition leaders to visit di family of di deceased former leader. "E dey hard for me to come yesterday [Wednesday] becos like dem tok bifor, e bin dey very hard to get flight to enta Katsina," Obi tell BBC for interview for Daura. E add say "Even wen you get di flight, e dey hard to land for di airport becos e don full. And mourning period na yesterday, today and tomorrow. And whoever dey hia now still dey part of di mourning"

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store