logo
#

Latest news with #SiminialayiFubara

‘No more acrimony, peace don come' - Wike tok afta e meet wit Tinubu and Fubara
‘No more acrimony, peace don come' - Wike tok afta e meet wit Tinubu and Fubara

BBC News

time27-06-2025

  • Politics
  • BBC News

‘No more acrimony, peace don come' - Wike tok afta e meet wit Tinubu and Fubara

'No more acrimony. Peace don finally come to di state.' Na wetin FCT Minister Nyesom Wike tok at di end of a peace meeting between im and Rivers State Govnor Siminialayi Fubara wit President Bola Tinubu for Aso Rock. Photos of smiles and handshake between Govnor Fubara, di State Assembly members with Minister of FCT Nyesom Wike and President Tinubu don raise hopes of a possible end to di emergency rule for di state. Govnor Fubara alongside Wike and Martins Amaewhule, speaker of di Rivers State House of Assembly and oda Assembly members meet with President Tinubu to broker a peace deal wey dey expected to return democratic governance to di state. Dis meeting dey expected to be a crucial part of di peace building process since President Tinubu declare a state of emergency wey suspend elected state executives and di House of Assembly on 18 March 2025, over three months ago. Afta di meeting, di FCT minister and Govnor Fubara say peace don return as dem don finally reconcile. Wike say dem don agree to work togeda wit di govnor and di govnor too don agree to work with dem. E say dem be members of di same political family wey dey disagree sometimes but now, dem don settle and dem come togeda to inform Mr. president. Photos from di meeting suggest a breakthrough in efforts to resolve di political crisis for di state as one photo show di president with Govnor Fubara and FCT minister all dey smile and shake hands. Oda photos show di FCT Minister and di govnor dey waka side by side with di Speaker Amaewhule and oda state lawmakers dey follow dem. Govnor Fubara say e happy say dis day of reconciliation don come to be as e dey necessary and important for di peace and progress of Rivers State. 'With di help of di president and di agreement of di leaders of di state, peace don return to Rivers State. We go do evritin within our power to make sure say we sustain am dis time around.' Govnor Fubara tok. How we reach here? All dis crises arise from disagreement between Govnor Fubara and di FCT Minister Wike with many reactions wey include: Many pipo don criticise di emergency rule wey see di appointment of a Sole administrator, Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe Ibas Rtd, from Cross River State to oversee affairs for di state. E lead to many court cases wey dey challenge am for Federal High Courts both for Port Harcourt and Abuja as dem insist say a tsate of emergency no require di president to suspend di elected govnor and Assembly members and impose a non-indigene on di state to oversee affairs. Even di appointment of sole administrators for di 23 LGAs for di State na anoda issue wey many criticize as dem say e no dey known to law and e only favour one party for di crises. Odas also criticise di dissolution of boards and agencies for di state and even di one wey National Assembly don approve, over N1trillion 2025 state budget as well as clearing some officials for some boards. Di approval of anoda Cross River State indigene, Michael Ekpai, to head di Rivers State Independent Electoral Commission RSIEC wey dey expected to conduct local goment elections also spark criticism. But di main questions na weda dis reconciliation moves go bring an end to di emergency rule soon? Wetin go happen to di court cases wey challenge di emergency rule wey di Federal High Courts never begin proper hearing for most of dem? Wetin go happen to di recent appointments wey di Nigerian Senate approve, dem go still hold or dem go dey suspended? All dis na wetin pipo dey wait to see how e go all play out.

Settlement dey go on between Wike and Fubara?
Settlement dey go on between Wike and Fubara?

BBC News

time12-05-2025

  • Politics
  • BBC News

Settlement dey go on between Wike and Fubara?

Wit di political crises for di oil rich Rivers State for southern Nigeria wey no dey finish, pipo dey wonder if a possible settlement go dey between di minister of di FCT Nyesom Wike and governor Siminialayi Fubara. Di political kasala between di two dey traceable to October 2023 wit an attempt to impeach di Governor by some Rivers Assembly members wey come divide di House into two. Majority of di lawmakers dey loyal di FCT Minister. Dis don cause plenti palava, defections and no-defections and many court cases wey end for di Supreme Court. Di Highest court of di land recognize di Martins Amaewhule led Assembly and ask di govnor to present di 2025 budget to dem. Di court also cancel local goment elections wey bin don hold for di State. On 18 March, 2025 President Bola Tinubu declare a state of emergency for di State and suspend di govnor, deputy govnor, and all di State Assembly members for an initial six months. In di meantime, di President appoint a sole administrator, Vice Admiral Ibom Ette Ibas Rtd. wey go dey di charge of di state and also mandate am to broker peace between di two. Dis action of di President to declare a state of emergency and appoint a military sole administrator for di state get various reactions. Some pipo clap hand for am say e do well to bring peace for di state, while odas say wetin e do no dey in line wit di Constitution of di Federal Republic of Nigeria, as di circumstances to declare a state of emergency no dey on ground for Rivers State wen e do so. Sake of dis, some pipo take to di streets to do protest wake and demand return of di govnor. Odas go court to seek a judicial interpretation of wetin di President do, especially to see if e dey constitutional for a President to suspend govnor and Assembly members wey pipo elect. Di courts neva decide on any of di cases. Reconciliation moves? Over di weekend, di Rivers State Govnor Siminialayi Fubara make comments for di first time since im suspension on 18 March 2025, almost two months ago. Govnor Fubara for di nght of tribute wey some Rivers Elders hold in honour of late Niger Delta statesman, Pa Edwin Kiagbodo Clark, say e no wish to return to office following im suspension if not for di pressure among Rivers pipo for am to come back to further im passion of leaving a lasting legacy for di common good. Di govnor say, "dis na di first time I dey tok publicly after di event of March 18. A lot of pipo no know wetin di situation be. No be about di force of activism. E get a time wia activism no fit solve problems. For dat reason I dey a bit careful." Oga Fubara come also caution pipo wey dey tok about di President and Minister of FCT to restrain and check demsefs, so as not to misrepresent tok and add say, 'Even some of you, una don ask una sef if I dey interested in going back? Una no see how I dey look better, you think say I dey interested in am? If I get my way, I no wish to go back dia. "My spirit don leave dat place long ago. So, I want amke evribodi focus on di tribute. E get some fights you no suppose engage in becos you need to ask di pesin if e want am. I get peace. If you know me and don dey see me bifor, you go see say I dey look better." Di govnor also emphasize di need for tolerance and peaceful coexistence among Rivers pipo over di lingering political situation wey push di state into emergency rule and call for caution as e urge im supporters not to dey confrontational but follow im peaceful path. 'Me sef want peace' - Wike On im part, di Minister of di Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, also don tok say di suspended govnor Siminalayi Fubara dey make reconciliatory moves and don come visit am along with two oda governors. Wike say, " di President don call for peace severally and I no fit sidon wen di President don call for peace and say, 'I no want peace'. Yes, im [Fubara] came wit two governors and one elder. Unfortunately, di two governors na APC governors. So, I no go pursue am. E say e want peace. Dat wan dey fine. I also want peace." Wike tok

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store