Latest news with #SpeedDarlington


BBC News
a day ago
- Entertainment
- BBC News
Why Nigerian authorities declare Speed Darlington wanted
Di National Agency for di Prohibition of Trafficking In Persons [Naptip] don declare Nigerian Content creator, Darlington Okoye wanted. Di anti-trafficking and sexual abuse agency declare Darlington wey pipo sabi as Speed Darlington, wanted in connection wit alleged offences wey include rape, cyberbullying, and cyberstalking. Dis dey come afta Naptip bin invite di rapper and content creator to come ansa kwesion on top accuse wia e admit say im bin sexually abuse pikin. Im wahala start sake of video wey im use im hand post for Instagram live wia e allegedly confess say im bin abuse 15-year-old girl. Dat time, e bin no clear weda e dey serious wit di comment or e just dey do content. Pipo begin drag Naptip put inside di mata sake of say dem want Naptip to torchlight di mata. Mr Okoye bin come for social media to allegedly tok about di time wey im sleep wit 15 year old pikin for hotel and e "disvirgin her and give am 2k". Wen pipo first drag Naptip attention to di trending video, di agency bin direct di mata to di Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency (DSVA) bifor dem decide to handle di case by demsefs. But dis time di agency say if anybody see am make dem report to dem. Authorities bin invite di content creator afta alleged child abuse 'confession video' Speed Darlington and controversy Speed Darling dey always enta tori sake of tins wey dey controversial. E neva tey wey im comot from police hand before e do dis one again. Police bin detain am sake of defamation case against Burna Boy becos of video wey blow afta US rapper Diddy arrest. For one one viral video wey bin spread ontop social media, e show wia, Speed Darlington dey ask Burna Boy how e take win im Grammy award in 2021. Di 39-year-old wey pipo sabi as "Akpi" ask di Grammy award winner, Burna Boy if Diddy rub "oil for im nyash" bifor e win di trophy. "E no tey afta Burna Boy post im foto wit Diddy na im, e win Grammy," e tok "I just dey wonder, Burna Boy I dey ask you kwesion. No vex . How many oil Diddy drop for your nyash bifor dem give you trophy." Video of im arrest bin dey trend ontop social media, afta some pipo escort am comot from im gate. Meanwhile, di main pipo behind di arrest of 'Akpi', as Darlington dey call imsef no come out come tok. Afrobeats giant Burna Boy wey evri body dem call im name no also chook mouth for di mata. Who be Speed Darlington Speed Darlington na di son of Nigeria singer Pericoma Okoye, wey die on 16 February 2017 for Okigwe, Imo state Southest Nigeria. Im mama na Queen Theresa Onuorah. E blow for Nigeria afta im song BangDadaDang! comot for 2017 and pipo start to dey meme am for social media. E even tok say na Diddy bin inspire dat im song wen im drop am. Dat song blow sotay pipo even start to dey play am inside clubs and parties at di time and na wen Speed Darlington start im social media career. At di time wey e get im first hit, im bin dey live for di US but a few years later, e come relocate back to Nigeria. Di 39 year old rapper dey very popular for im social media persona wey im dey take tok about a lot of issues, mostly sex and how to make money.


BBC News
29-05-2025
- Entertainment
- BBC News
Authorities invite content creator 'Akpi' Speed Darlington afta damning child abuse confession video
Di Nigerian anti-trafficking agency, Naptip don invite rapper and content creator, Speed Darlington to come ansa kwesion on top alleged admission say im sexually abuse pikin. Dis dey come sake of video wey Darlington use im hand post on Tuesday for Instagram live wia e allegedly confess say im burst di virginity of one 15-year-old girl. E no clear weda e dey serious wit di comment or e just dey do content. Na dis one make pipo hala give di National Agency for di Prohibition of Trafficking (Naptip) say make dem torchlight di mata. Di man wey im real name na Darlington Okoye bin comot on social media to allegedly tok about di time wey im sleep wit 15 year old pikin for hotel and e "disvirgin her and give am 2k". Wen dem first drag Naptip attention to di trending video, dem bin direct di mata to di Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency (DSVA) bifor dem decide to handle di case demselves. For di statement wey Naptip release, dem say no be only dat video make dem invite am but dem bin get oda archived videos wey currently dey in cirulation wia im admit di same tins and "make degrading commentary about minors dem". Dem tok say if di mata wey oga Darlington tok for di video na true na "offences under di Trafficking in Persions (Prohibition) Enforcement Act of 2015 and di Cybercrime (Prohibition, Prevention, etc) Act of 2015". Dem want make e show for dia headquarters for Abuja or else dem go do more legal actions. Meanwhile, Speed Darlington don clap back on all di pipo wey don comot to tok bad about am sake of say e nack pikin. For yet anoda video, e comot tok say, "If I know say 15 go bring me dis kain attention, I for tok say na 12, make una head catch fire. Na becos say I dey south nau, dis na wetin I bin dey follow my lawyer tok, na bicos I dey southern Nigeria, you go fit dey attack me like dis if we dey sokoto? "You no go fit disrespect me like dis. Mr advocate, VDM, go north nau! Shebi you carry am for head". E come give example of one tori of wia 12 year old girl wey marry man wey dey im 50s, e say e see di tori for 2021. Adding say, "Igbo girl na for south she get power!" Di last time Speed Darlignton bin get legal kasala All dis dey come just few months, afta Speed Darlington comot police custody following case of defamation against Burna Boy becos of video wey blow afta US rapper Diddy arrest. One viral video wey dey circulate ontop social media show wia, Speed Darlington dey ask Burna Boy how e take win im Grammy award in 2021. Di 39-year-old wey pipo sabi as "Akpi" ask di Grammy award winner, Burna Boy if Diddy rub "oil for im nyash" bifor e win di trophy. "E no tey afta Burna Boy post im foto wit Diddy na im, e win Grammy," e tok "I just dey wonder, Burna Boy I dey ask you kwesion. No vex . How many oil Diddy drop for your nyash bifor dem give you trophy." Video of im arrest don dey trend ontop social media, afta some pipo accompany am comot for im gate. Meanwhile, di main pipo behind di arrest of 'Akpi', as Darlington dey call imsef neva come out come tok. Afrobeats giant Burna Boy wey evri body dem call im name also neva chook mouth for di development. Who be Speed Darlington? Speed Darlington na di son of Nigeria singer Pericoma Okoye, wey die on 16 February 2017 for Okigwe, Imo state Southest Nigeria. Im mama na Queen Theresa Onuorah. E blow for Nigeria afta im song BangDadaDang! comot for 2017 and pipo start to dey meme am for social media. E even tok say na Diddy bin inspire dat im song wen im drop am. Dat song blow sotay pipo even start to dey play am inside clubs and parties at di time and na wen Speed Darlington start im social media career. At di time wey e get im first hit, im bin dey live for di US but a few years later, e come relocate back to Nigeria. Di 39 year old rapper dey very popular for im social media persona wey im dey take tok about a lot of issues, mostly sex and how to make money.