logo
#

Latest news with #mopup

Vegetation fire near Roseville high school burns 10 acres
Vegetation fire near Roseville high school burns 10 acres

CBS News

time05-07-2025

  • Climate
  • CBS News

Vegetation fire near Roseville high school burns 10 acres

A fire broke out near a Roseville high school on the Fourth of July, the Roseville Fire Department said. Just before midnight, firefighters responded to a vegetation fire in the field near West Park High School. The fire was bordered by Bob Doyle Drive, Hayden Parkway and Panther Place. According to Roseville Fire, crews were able to use natural fire breaks to contain the 10-acre fire, and no structures were damaged. Firefighters stayed overnight to do mop-up operations.

All you need know about Jamb mop-up exam
All you need know about Jamb mop-up exam

BBC News

time23-06-2025

  • Politics
  • BBC News

All you need know about Jamb mop-up exam

Di Joint Admissions and Matriculation Board don set Saturday, 28 June, to conduct di 2025 UTME mop-up examination. UTME na entrance exams wey pipo wey dey find admission to enta Nigeria public and private universities dey write. Jamb board bin don announce earlier say dem go conduct mop-up exam for candidates wey bin miss di UTME exam for April and di rescheduled UTME exam for May. Dem tell di candidates wey miss di 2025 UTME to start to print dia registration slips from Monday, 23 June. Di slip contain dia examination centres and di time of examination. According to di exam join bodi na 96,838 candidates dem reschedule to sit for di mop-up exam for 183 centres across di kontri. JAMB say di first session for di examination go start by 8 a.m West African time. Wetin happun for di 2025 UTME? Di Join body wey dey run Nigeria university-entrance exams bin admit say dem experience "technical glitch" wey affect some of di results for dis year tests, afta nearly 80% of students bin get low grades. Students bin complain say dem bin no fit log in to di computers, questions no bin dey show and light wahala make am impossible to take di examinations. Di low pass rate bin spark widespread outrage, especially afta one candidate take her own life. Faith Opesusi Timileyin, 19, wey bin wan study microbiology for university, die afta she swallow poison, her family tok. Her father and elder sister bin tell BBC say she bin write di exam for di second time and she get 146 marks out of 400, lower dan 193 wey she get di last year. "Di pain make her take her own life," her father, Oluwafemi Opesusi, tell BBC Pidgin. Generally 200 or above out of 400 dey enough to get a place for university for di exams wey Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) dey organize. Only 400,000 out of di 1.9 million students bin achieve dat mark, na one of di worst performances in recent years. Afta many pipo hala well- well, Jamb say dem go allow students for some areas to retake dia exams. One student, Favour Eke, bin tell BBC say 10 of di165 questions no appear for di screen - all wey she see na multiple choice options for di answers. "Dem tell us to omit di blank questions and kotinu di exam but e bin dey very hard to concentrate afta dat," she tok. She bin also experience technical problems to get her results, e mean say e dey very unlikely for her to get into university dis year - wey be di third time she don take di exams. She bin write di test for di capital, Abuja, wey no be one of di centres wia students bin retake dia exams, dis whole tin really spoil her mind. Anoda student say she bin get trouble to log in to di computer bifor anoda pesin profile mysteriously appear for di screen, wey show different kwesions and den di machine briefly shut down completely. "I bin no get answer to all di kwesions wen dem tell us say our time don end becos a lot of my time I bin waste am sake of those technical difficulties," im tok. Di exam body bin apologise for di "painful damage" and "di trauma wey e bin subject affected Nigerians". For press conference, JAMB registrar Ishaq Oloyede break down in tears as im apologise. Im announce say almost 380,000 candidates for 157 bin dey affected centres dem from a total of 887, wey go able retake dia exams starting from Saturday. Di zones wey dey most affected na Lagos and several states for south-east. JAMB blame a failure of di computer system to upload exam responses by candidates in these areas during the first days of di exams. E say na di "unusual level of public concerns and loud complaints" na im "prompt us to do an immediate audit or review". Ordinarily, dis no for happun for June, it said. Di national exam, wey dem dey call Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME), na computer-based test wey be requirement for those wey wan join universities and oda tertiary institutions. Di 2025 test, wey JAMB organize for March, bin dey marred by disruptions due to power outages in some areas. Di head of di exams body earlier bin defended di poor results, e say say e reflect di "true academic abilities" of di students and na becos dem dey clamp down on cheating. Many Nigerians on social media bin dey cal for accountability, with some seeking Oloyede' resignation. Opposition figure Peter Obi bin say while di admission of fault dey commendable,di issue wey dem raise "na very concerning issue on glitches and di grave havoc" for critical institutions. Rights activist Rinu Oduala say na "incompetence. Na educational sabotage. Dem suppose arrest am immediately."

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store