logo
Public facilities wey don get new name since 2023

Public facilities wey don get new name since 2023

BBC News18-07-2025
Within two years wey di Nigeria president office, President Bola Tinubu start im administration e don commission and rename several goment properties afta im name, politicians and popular figures for Nigeria.
On Thursday, president Bola Tinubu rename di University of Maiduguri (UNIMAID) afta di late former President Muhammadu Buhari.
Buhari die at di age of 82 for one London clinic on Sunday and im family bury am on Tuesday for Daura, Katsina state.
During di Federal Executive Council (FEC) wey hold in honour of di late former president on Thursday, Tinubu rename UNIMAID to Muhammadu Buhari University, Maiduguri.
"Di ceremony for di special session of di Federal Executive Council honour di eighth Nigerian leader— civil war hero, former military head of state, and anti-corruption advocate — passing on July 13, with legacy of discipline and patriotism," di statement tok.
"President Tinubu, open di floodgates of tributes in di presence of later leader children, e rename di 50-year-old University of Maiduguri Muhammadu Buhari University."
UNIMAID to Muhammadu Buhari University
Dem establish di university in 1975, under military goment in di capital city of Borno State, in northeast Nigeria. UNIMAID get 16 faculties and 127 programmes, wit 26 000 students.
Now, di president don rename am as Muhammadu Buhari University, Maiduguri.
Buhari serve as Nigeria democratically elected president from 2015 to 2023, e also rule as military head of state from January 1984 to August 1985.
Abuja International Conference Centre to Bola Ahmed Tinubu International Centre
Recently, dem rename Abuja International Conference Centre wey former President Ibrahim Babangida Tinubu to Bola Ahmed Tinubu International Centre.
Di Nigeria Minister of Federal Capital Territory, Nyesom Wike also name halls inside di centre afta some politicians.
Im name halls afta Vice President Kashim Shettima, Chief Justice of Nigeria Kudirat Kekere-Ekun, Senate President Godswill Akpabio and Speaker of di House of Representatives Tajudeen Abbas.
According to di FCT Minister, dis na im way to say thank you to dem for supporting im FCT Administration and for how di Judiciary and Legislative arms of goment dey collabo wit executive.
Former President Ibrahim Badamosi Babangida bin build di Abuja International Conference Centre for 1991.
According to Wike, Babangida bin build to ICC to host one Organization of African Unity meeting.
Oda tins goments don rename since 2023
In March 2024, Niger State govnor, Mohammed Umaru Bago, rename di Minna International Airport from Abubakar Imam Kagara International Airport to Bola Ahmed Tinubu International Airport.
Many residents of di state para ova di new changes accusing di govnor of operating Tinubu-led goment for dia state.
In June 2025, president Bola Tinubu also name one 300-bed specialist hospital for Millennium Square in Kaduna state as Bola Ahmed Tinubu Specialist Hospital.
In January 2025, president Bola Tinubu commission newly built military barracks in Abuja and name di facility afta imsef "Bola Ahmed Tinubu Barracks."
Di barrack go accommodate military personnel and provide dem facilities like sport center, clinic, worship centers, roads, among others.
During di commission, president Tinubu describe di officers of di Nigerian Armed Forces as "heroes" of Nigeria.
In December 2024, dem rename di Immigration Headquarters afta Bola Ahmed Tinubu Technology Innovation Complex.
Di president also name, di Murtala Mohammed Expressway for Abuja afta Nobel Laureate, Wole Soyinka in June 2024.
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Who be Nentawe Yilwatda, APC new National chairman
Who be Nentawe Yilwatda, APC new National chairman

BBC News

timea day ago

  • BBC News

Who be Nentawe Yilwatda, APC new National chairman

Di ruling All Progressives Congress (APC) don announce Professor Nentawe Goshwe Yilwatda as dia new National Chairman. Di Proferssor go replace Abdullahi Ganduje wey resign from di position for June. Dem choose di new chairman for dia 14th meeting of di National Executive Committee (NEC) wey dem hold for Abuja on Thursday. Appointment of Yilwatda dey come afta Ganduje resign for June 27, 2025, and Ali Bukar Dalori, di Deputy National Chairman of di party bin act till in dat capacity Yilwatda na 56-year-old man from Plateau State and di current Nigeria Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management, and Social Development. Di party leaders bin support Yilwatda for di position including President Bola Ahmed Tinubu, afta dem nominate am. Profile of Nentawe Yilwatda Dem born Prof Yilwatda on August 8, 1968, for Dungung, Kanke Local Govment Area of Plateau State. E get degree for Electrical/Electronic Engineering from di Federal University of Agriculture, Makurdi for 1992, a Master degree from Abubakar Tafawa Balewa University, Bauchi, and PhD for Digital Systems Engineering from di University of Nigeria, Nsukka. E be registered engineer wit di Council for di Regulation of Engineering for Nigeria (COREN). Also member of di Nigerian Society of Engineers, di Institute of Electrical and Electronics Engineers, and di Solar Society of Nigeria. Yilwatda journey include both im experience for public and private sectors. E bin serve as di Resident Electoral Commissioner for Benue State under di Independent National Electoral Commission (INEC) from 2017 to 2021. For 2022, Yilwatda bin resign from INEC to contest for di APC govnorship primary for Plateau State,and e become di party candidate. Meanwhile, lose di 2023 election to Caleb Mutfwang of di Peoples Democratic Party (PDP). For October 2024, President Tinubu appoint am as di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management, and Social Development. E go kontinue to dey hold im Minister role join di APC chairmanship position.

Datti-Ahmed and Abure reconciliation - wetin be di next tin for Peter Obi?
Datti-Ahmed and Abure reconciliation - wetin be di next tin for Peter Obi?

BBC News

time2 days ago

  • BBC News

Datti-Ahmed and Abure reconciliation - wetin be di next tin for Peter Obi?

New tins wey be like say drama wan start don begin happun for Labour Party. Di vice presidential candidate of di Labour Party for di 2023 election, Senator Yusuf Datti Baba-Ahmed, bin attend one National Executive Committee (NEC) meeting wit Julius Abure wia e say e wan reconcile all parties. Baba-Ahmed say im oga wey be di Labour Party presidential candidate for 2023, Peter Obi dey aware of im presence to di Abure-led NEC meeting. Dis na afta several kasala don rock di Labour Party since di 2023 elections bin end wit different factions from Abure and also Senator Nenadi Usman. Na di different factions within di Labour Party di Vice presidential candidate Baba-Ahmed bin tok say im wan bring togeda. During di meeting, Datti show support for di Abure-led leadership of di Labour party - e tok say im mission na to bring evribodi for di party togeda. "Labour Party no be party to waka away from. To di best of our knowledge Peter Obi na still member of Labour Party. Dis party no be one to abandon and I wish to reconcile all parties " Datti also tok say im and im oga, Obi dey solidly togeda and di tok about coalition no be threat as dem no be member of any political party wey dem form. Howeva, di Labour Party chairman Abure say anybodi get right to join oda political parties but e gatz dey according to di constitution. "Evri Nigerian get di right to belong to any political party of dia choice. Anyone wey feel say dem wan dey wit any group, na dem get di choice but di constitution of di party dey clear say you no fit belong to two political parties at di same time." Obi and Abure no be padi padi for now, sake of di different kasala wey dey rock di party. Meanwhile, Senator Nenadi Usman wey also dey lay claim as di Interim National Chairman of Labour Party, say di decision of Datti dey personal to am. According to di statement by Ken Eluma Asogwa, Senior Special Adviser on Media, to Nenadi, e allege say di court no recognise Abure as Labour Party chairman, but rather, na she be di chairman of di party. Although dis na part of di wahala wey di labour Party dey face, Senator Nenadi say e no dey right for Datti to refer to Abure as di party chairman, and dat evri member of di Labour Party gatz follow wetin di court rule. "While di party respect di right of Dr. Baba-Ahmed and oda members to hold personal views, e dey important to rememba say di acceptance of di judgements of di Supreme Court no be mata of choice but e dey compulsory." Senator Nenadi say e good say Datti wan reconcile all parties back to di Labour Party but e gatz dey according to di 'respect for di rule of law and existing legal realities.' Di gbas-gbos for Labour Party no be today e just start. For 4 September 2024, one faction of LP hold NEC meeting for Umuahia, di Abia State capital, wia dem announce madam Usman and 28 odas as membas of di new caretaker committee wey go handle di affairs of di party. Meanwhile, anoda National Convention bin don happun bifor for Nnewi, Anambra State for March 2024 wia dem put Julius Abure to remain as di party chairman. Di mata later go court, and still, both factions dey claim say na dem be di chairman of di party. And even Peter Obi no too show full support for wetin dey happun for di party. For July 2025, Peter Obi say e dey ready for coalition wey go always put Nigerians first for all dia decisions. Even as Labour Party give am 48-hours make e resign from di party sake of im decision, Obi say to join coalition na deep reflection for am and e go do evritin wey go move di kontri forward. How Obi and Datti become 2023 flagbearer for LP Peter Obi and Datti Baba-Ahmed na Labour Party candidate for 2023 elections, and since den, dia mata dey enat each oda. Labour party reveal Datti as Peter Obi running mate for Friday, 9 July, 2022, bifor di presidential election. Senator Datti come from a very popular family wey comot from Zaria, Kaduna State inside northwest Nigeria, and na part of wetin make am bring am on board be dat. Senator Datti Baba-Ahmed follow BBC tok for one interview wia e say di reason why e accept to be Peter Obi running mate na sake of say dem get di same principle. Dat time Baba-Ahmed, say e decide to join Labour Party becos of im stand on corruption. "Di main reason why I decide to run with Peter Obi na sake of say we wan rescue Nigeria." E tok dat time. As at dis period, Peter Obi neva react to Datti decision to support one faction of di party and e neva also tok anytin about Labour Party decision ontop coalition mata.

Nigeria's Senate approves President Tinubu's $21 billion external borrowing plan
Nigeria's Senate approves President Tinubu's $21 billion external borrowing plan

Reuters

time2 days ago

  • Reuters

Nigeria's Senate approves President Tinubu's $21 billion external borrowing plan

ABUJA, July 23 (Reuters) - Nigeria's Senate has approved President Bola Tinubu's plan for more than $21 billion in foreign borrowing to plug shortfalls in the 2025 budget, a senior lawmaker said late on Tuesday. Tinubu asked parliament to approve the borrowing in May. "With this approval we now have all revenue sources, including loans, in place to fully fund the budget," Solomon Adeola, Senate chair on appropriations, told reporters.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store