logo
Benue attacks: 'Dem come guerrilla style and begin dey butcher pipo'

Benue attacks: 'Dem come guerrilla style and begin dey butcher pipo'

BBC News03-06-2025
Di number of pipo wey don die from di attacks on Gwer West and Apa Local Goment Areas of Benue State don rise to ova 50 local authorities tok.
Suspected herdsmen attack residents of Tse-Antswam for Naka town, wey be headquarters of Gwer West LGA and Edikwu Ankpali for Apa local goment area of Benue state.
Tori be say many pipo die, as oda pipo run to save dia lives.
According to di Chairman of Gwer West Council Mr. Victor Ormin and di traditional council, Chief Daniel Abomtse bin confam say dem bin recover 21 deadibody on Sunday.
Chief Abomtse di Ter Nagi, tok say di attackers bin come in guerrilla style wen dem attack Tse Antswam. Im add say many pipo get different degree of injuries.
"In fact, di way dem butcher some of di pipo I doubt if dem go survive, we still dey search becos many pipo bin run inside bush wit gun wounds and some also enta inside well to escape di herdsmen," di monarch tok.
According to Chief Abomtse, di community wey dis attack happun dey directly opposite di military check point along Naka/ Makurdi road.
Edikwu record 37 deaths
Meanwhile for Edikwu Ankpali for Apa Local Goment Area, di causality figure hit na 37.
Di Chairman of Apa Local Goment Area, Adam Ogwola, wey confam di tori say dem still dey expect di number of death victims to increase as dem still dey search and dem dey see more deadbody. "Di attack dey devastating"
"Di pipo wey wound dey for general hospital already and dey get medical attention".
One community leader, John Ikwu also confam say dem bin see 25 deadbody on Sunday for Edikwu Ankpali.
Di community leader say time don reach wey dem go begin confront di jaguda pipo as im describe di killing as barbaric and unwarranted.
Im say na heartless killers dey attack dia communities evriday without control.
For statement wey di Benue State Police Command release on Monday, through dia tok-tok pesin Udeme Edet, dem say di Commissioner of Police, Emenari Ifeanyi don relocate di Area Commander to Apa.
Im also direct di tactical team to take over Naka as im deploy resources to flash points for di state including Apa and Gwer-west Local Goment Areas.
For police statement, dem tok say na ten and twelve pipo die for di two attacks and five odas bin dey hospital.
"For di last one month, personnel wey we post to dis areas don dey fight wit dis attackers and dem don suppress dem for most areas.
Unfortunately, dis bandits dey search for vulnerable pesins and attack dem, dem kill some pipo on 1st June, 2025."
Di CP dem redeploy personnel to cover up entries and exits to flash points.
In di last two weeks, tori about different type of death don full for social media and news channels.
Benue state na one of di flash points wey suspected herders dey attack communities and kill pipo.
For April, di number of death for Benue herdsmen attack on Logo and Gbagir rise to 56.
Even though di govnor bin don condemn dis attacks many times, e still dey happun.
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Security officers block Senator Natasha Akpoti-Uduaghan from entering di National Assembly
Security officers block Senator Natasha Akpoti-Uduaghan from entering di National Assembly

BBC News

time2 hours ago

  • BBC News

Security officers block Senator Natasha Akpoti-Uduaghan from entering di National Assembly

Nigerian female senator wey bin raise allegations of sexual harassment against di senate president, don dey denied entry into di National Assembly building for Abuja dis Monday. Di senate bin suspend Senator Natasha Akpoti-Uduaghan for six months for March dis year afta dem find her guilty of flouting dia standing rules, but on 5 July, 2025, di federal high court for Abuja rule say di senate "can and should recall her". Di senate spokesperson, Yemi Adaramodu, bin don tok say di ruling no be binding order but na mere advisory to di senate leadership wey dem fit obey or not. But Akpoti-Uduaghan bin tell her supporters say she go resume for di senate chambers on Tuesday in accordance wit di court ruling. Security presence for di entrance of di National Assembly complex bin dey tighter on Tuesday in anticipation say di senator fit show up, and she true-true try to gain access into di complex but dem deny her entry. Dem first stop her vehicle for di outermost gate, but di senator come down and waka pass di first barricade wia another batch of security personnel stop her again. We dey update dis tori.

Mali court rejects appeal to release four Barrick employees, judge says
Mali court rejects appeal to release four Barrick employees, judge says

Reuters

time3 hours ago

  • Reuters

Mali court rejects appeal to release four Barrick employees, judge says

BAMAKO, July 22 (Reuters) - A court in Mali on Tuesday rejected an appeal by Barrick Mining ( opens new tab to release four employees arrested last November, judge Samba Sarr said, the latest development in a long-running standoff between the Canadian firm and the Mali government over taxes and ownership of mining operations in the country. The appeal by the company, which has dismissed the allegations against the four local employees as baseless, was determined by the judge to be "unfounded", said Alifa Habib Kone, a lawyer for Barrick. The employees face charges including money laundering and violation of other regulations, Kone said. Barrick has said it refutes the charges against its employees. Barrick and Mali's military-run government have been in negotiations since 2023 over the implementation of a new mining code that raises taxes and gives the government a greater share in the country's gold mines. Barrick owns 80% of the Loulo-Gounkoto mining complex in Mali and the government owns the rest. Operations have been suspended since mid-January after the government blocked Barrick's gold exports and seized three metric tons of its stocks. Malian authorities arrested the four employees in late November and they have been in pre-trial detention in Bamako, according to Barrick's website. Mali also issued an arrest warrant last December for Barrick CEO Mark Bristow who is based in Toronto. He is accused of money laundering and violating financial regulations, according to the warrant document. Governments in Mali, Burkina Faso and Niger - all led by juntas - are all seeking to renegotiate new terms with gold miners to gain a bigger share of mining revenue at a time when gold prices have soared. Mali represents 14% of Barrick's gold output and the company generated $949 million in revenue from its operations there in the first nine months last year.

How South Africa Education Minister enta wahala wey lead to her sack
How South Africa Education Minister enta wahala wey lead to her sack

BBC News

time4 hours ago

  • BBC News

How South Africa Education Minister enta wahala wey lead to her sack

For South Africa, President Cyril Ramaphosa don sack di Minister of Higher Education and Training, Nobuhle Nkabane from her role and sharply replace her afta different controversies. Dis sack dey come at a time wey di South African parliament members bin dey worry ova how Nkabane bin handle some appointment for her ministry. Na on Monday night 21 July 2025, President Ramaphosa bin release statement say make di Higher Education Nkabane comot for office. Tori be say key coalition partner, di Democratic Alliance (DA) bin accuse di minister of misconduct for her ministry, even though she don deny am. Nkabane na member of di African National Congress (ANC), same political party wey di president and oda cabinet members belong to. Immediately afta her sack, DA through dia national tok tok pesin Karabo Khakhau say di minister bin lie to cover up di corruption wey happun for her ministry. "Di departure of Minister Nobuhle Nkabane, afta lying to Parliament to cover up ANC cadre deployment, come afta relentless DA pressure for di fight against ANC corruption, wrongdoing and criminality." Di DA allege say bin facilitate di appointment of ANC-linked individuals to skills development boards and she bin lie to parliament to hide am. Wetin Nobuhle Nkabane do wey lead to her sack For early July 2025, DA bin write to lay criminal charges against di Minister of Higher Education and Training, Nkabane. DA submit di charges for di Cape Town Central Police Station wia dem say di minister bin dey lie give di parliament and abuse her position to give appointment to ANC members. For dia 1 July 2025 statement through dia national tok tok pesin Karabo, wey also be Member on portfolio committee on Higher Education and Training for di South Africa parliament, di party say Nkabane cover up fraudulent appointment into one particular board wey dey under her ministry. "Na time to fire Minister Nkabane and clean out di ANC criminal network from di heart of govment," DA statement tok afta dem accuse President Ramaphosa say im no take action. "Dis lies na part of a calculated attempt to cover up di fraudulent appointment of ANC-linked individuals to Sector Education and Training Authority (SETA) boards." DA accuse Minister Nkabane say she tell Parliament say di appointment process into di SETA board dey overseen by an "independent" evaluation panel, but no be so. "E don dey exposed say di so-called panel dey full of individuals from her own department and political allies, including her Chief of Staff and an ANC Youth League leader. Minister Nkabane don break di law and violate her oath of office." Afta di charges, DA confam say dia criminal complaint di ANC Minister Nkabane don dey under investigation by di Priority Crimes Directorate, di HAWKS. By 7 July 2025, di minister don dey under investigation for di alleged misconduct wey dem sama her. "ANC Minister Nkabane now face a Priority Crimes Directorate investigation for fraud and di statutory offence to lie to Parliament. She dey face allegations of manufacturing a scheme wey see how senior ANC personalities dey deployed to high-paying SETA Board jobs" For 18 July 2025, Nkabane and oda members of her ministry including di Chief of Staff suppose show face for di parliament to come defend wetin happun for di SETA board wia allegations dey say na her party members she dey give appointment. On dat day, di minister no show up, and even her Chief of Staff too no show. Afta plenti drag drag, President Ramaphosa issue statement wey announce di sack of di Higher Education Minister, and a replacement for her. Meanwhile, on di same day wen dem fire her, Nkabane also release statement to announce her resignation from di ministry. How Nobuhle Nkabane enta South Africa politics Dem appoint Nobuhle Nkabane as Minister of Higher Education for 3 July 2024. Afta she win election as a Member of Parliament for 2019, she later serve as Deputy Minister of Mineral Resources and Energy from August 2021 to June 2024. Dr Nkabane enta politics for young age afta she join di ANC wia she serve for various leadership positions of di ANC Youth League and di ANC Women League for regional and Provincial Executive Committee level. She dey among di leaders of di ANC Youth League Sisonke Region wey advocate for di renaming of Sisonke District Municipality to Harry Gwala District Municipality, to honour di struggle of Harry Gwala. Nkabane rise to different positions bifor she finally find hersef for di Higher Education and Training Ministry wey she head. Profile of new South Africa Education Minister For di same vein, President Ramaphosa announce di appointment of Buti Manamela as di new Minister of Higher Education and Training. "In line wit section 91 (2) of di Constitution of di Republic of South Africa, Mr. Buti Kgwaridi Manamela dey appointed as Minister of Higher Education and Training," di President tok for im statement. Bifor im appointment, Manamela serve as Deputy Minister of Higher Education and Training for di Republic of South Africa, since June 2024. E be former Deputy Minister for di Presidency, former Deputy Minister of Higher Education, Science and Innovation, and e don be a member of Parliament since 2009. E be also member of di South African Communist Party Central Committee since 2012 and dey elected into di ANC National Executive Committee for 2022. Manamela get Masters Degree for Public Policy and Development Management, and study Digital Electronics for di Tshwane North TVET College (former Mamelodi College). E also serve as Deputy President of di South African Students Congress (SASCO), former President of South African College Student Association (now SAVETSA) and dey elected as National Secretary of di Young Communist League of South Africa for 2003 until 2014. Manamela go now take ova from Nkabane to head di Higher Education and Training Ministry. Also Dr Nomusa Dube-Ncube go now act as di Deputy Minister of Higher Education and Training.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store