
Who be Nigerian actress Angela Okorie wey dey di centre of Nollywood drama?
Celebrity life dey come wit fame, influence, money and constant public drama wey dey make dia life different from ordinary pesin.
Nollywood actress Angela Okorie don dey di centre of di ongoing gbas-gbos between am, Mercy Johnson and Regina Daniels wey dey trend ontop social media.
Angela recently make one post ontop social media say she don forgive Mercy Johnson, wey she bin get beef wit but Regina Daniel respond say "we no dey forgive for dis side". Na dis make Angela fire back.
She verbally insult Regina Daniels claiming Regina marry her husband, Nigeria politician Ned Nwoko for money.
Regina deny her claim and respond say na Angela dey beg her husband make im support am financially for her next project.
Afta days of staying quiet, Mercy Johnson don tok say she go speak up for hersef and clear di air about di allegations against her.
Who be Angela Okorie
Angela Okorie na ogbonge musician and actress for Nollywood wey start her career as a model, bifor she break into stardom for 2009 wit her first feem 'Holy Serpent' and she don feature for several movies including 'Heart of a Widow' and 'Secret Code.'
She don win several awards for di Nigeria movie industry. Angela win di 'Best Supporting Actress' category for di 2015 edition of di City People Entertainment Awards.
Angela come from Enugu State, southeast Nigeria, but dem born am for Cotonou, Benin Republic, bifor she relocate to Nigeria wia she bin start to model for cosmetic brand for 2005 until she find her real passion wey be acting for 2009.
Di actress get one pikin from her previous marriage wit Chukwuma Orizu. Di two dey togada for ten years bifor Angela announce her divorce ontop Instagram in 2015.
She claim say her ex-husband no wan make she dey work as actress but di two still maintain dia relationship and dem still dey co-parent dia son.
Beef for Nigerian entertainment industry
Beef for Nigerian entertainment industry no be new tin. From music to movies, drama between celebrities don become almost as popular as di work dem dey produce.
Weda na about ego, competition, betrayal, or just plain misunderstanding, beef dey always make headlines, and sometimes e dey even boost careers.
For Nollywood, beef fit spark between actors, directors, producers, or even influencers. Many times, na ova who dey inside big role, who dey earn more endorsement deals, or who dey get more attention from di media. Oda times, na about personal issues wey dem bring into public space. E fit also be old friendship wey turn to enmity or comments wey pesin make for interview wey go di wrong way.
Music is even dey more notorious. From di days of 2Baba vs Blackface, to more recent beef between new cats for di music industry, Nigerian entertainment industry don see im fair share of ego battles.
But shey na all beef dey bad? Some pipo believe say e dey create healthy competition.
Wen two top entertainers dey compete, dem dey often drop dia best work. Di fan and di industry benefit in dat manner.
But beef fit lead to division as fans dey pick sides and engage in toxic trolling online.
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


Daily Mail
a day ago
- Daily Mail
'Absolutely Haunting' crime thriller compared to The Handmaid's Tale rockets up Netflix charts - as viewers beg 'give us more like this please!'
Though it was released in Nigeria back in March, Baby Farm only became available on Netflix UK on June 20th 2025. The series follows young Adanna (Onyinye Odokoro), who falls pregnant out of wedlock. Faced by her parents' reprimanding attitude, she runs from home to find her boyfriend in Lagos, but instead, is seduced by an exploitative baby farming scheme called The Evans Foundation, masquerading as a benevolent NGO. The Evans Foundation is run by a pair of married British expatriates, who, living in Nigeria, exploit vulnerable pregnant women for profit. Adanna and her similarly imprisoned peers, including Ebun (Genoveva Umeh) and Emem (Ruby Akubeze), discover that at the heart of the Evans Foundation is a sinister operation with a hidden agenda. 'The series draws chilling parallels to real-life horrors, grounded by a powerful performance from Onyinye Odokoro as Adanna, a woman pushed to the edge, yet never backing down,' said Black Film Wire in their review. 'But it's Genoveva Umeh that left me cold. Her portrayal of Ebun isn't just haunting - it's the kind of performance that burrows under your skin and refuses to leave: layered, grounded, and absolutely haunting.' Other compared the show to dystopian hit The Handmaid's Tale, which sees women oppressed by a Christian theocracy and forced to carry babies for the rich and powerful amid a global fertility crisis. The Lagos-set series aims to highlight the reality of women trapped in exploitative baby factory institutions across the world. 'When I started to research (the script), it was very eye-opening and very horrific,' said Odokoro, in an interview with Arise. 'I believe that film has to make comments about what's happening in society. It is very important and very relevant.' This series is more than just a thriller – it's a powerful story rooted in real-life issues told through the lens of bold, cinematic African storytelling,' said the show's executive producer Mo Abudu. 'With breathtaking visuals, a gripping narrative and an outstanding cast and crew, Baby Farm will keep audiences on the edge of their seats while sparking vital conversations. We can't wait for the world to experience it.' Its popularity signals global momentum for Nollywood, as Baby Farm sparks impassioned conversation online. One fan said: 'This is giving me Handmaid's Tale and I am getting angry all over again.' Another chimed in: 'Baby Farm on Netflix gives me a Get Out vibe. 2 episodes in, and I'm unsettled. Who is the actress playing Nurse Bolade? She creeps me out.' 'Baby Farm left me absolutely impressed! The movie was fantastic! My favourite character was Ebun, I could really see how her childhood shaped her personality. 'Her goofiness was the bare minimum she classified as love, which was both heartbreaking and eye-opening,' one fan added. 'Just finished Baby Farm on Netflix! It was so good fr, yet it somehow flew under the radar,' someone else said. Its popularity signals global momentum for Nollywood, as Baby Farm sparks impassioned conversation online 'Meanwhile, some other movies with way less depth or weaker storytelling get all the hype just because they feature popular actors or because of social media buzz.' 'I just finished watching Baby Farm on Netflix. I didn't expect to, but I was gripped. Great storytelling. And Genoveva Umeh? That girl is a superstar,' one fan wrote. While another added: 'I know I'm late and that's cos Netflix finally pitied us but Baby Farm was so good! You people didn't talk about it enough.' Baby Farm is available to stream on Netflix.


BBC News
2 days ago
- BBC News
Why Nigerian authorities declare Speed Darlington wanted
Di National Agency for di Prohibition of Trafficking In Persons [Naptip] don declare Nigerian Content creator, Darlington Okoye wanted. Di anti-trafficking and sexual abuse agency declare Darlington wey pipo sabi as Speed Darlington, wanted in connection wit alleged offences wey include rape, cyberbullying, and cyberstalking. Dis dey come afta Naptip bin invite di rapper and content creator to come ansa kwesion on top accuse wia e admit say im bin sexually abuse pikin. Im wahala start sake of video wey im use im hand post for Instagram live wia e allegedly confess say im bin abuse 15-year-old girl. Dat time, e bin no clear weda e dey serious wit di comment or e just dey do content. Pipo begin drag Naptip put inside di mata sake of say dem want Naptip to torchlight di mata. Mr Okoye bin come for social media to allegedly tok about di time wey im sleep wit 15 year old pikin for hotel and e "disvirgin her and give am 2k". Wen pipo first drag Naptip attention to di trending video, di agency bin direct di mata to di Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency (DSVA) bifor dem decide to handle di case by demsefs. But dis time di agency say if anybody see am make dem report to dem. Authorities bin invite di content creator afta alleged child abuse 'confession video' Speed Darlington and controversy Speed Darling dey always enta tori sake of tins wey dey controversial. E neva tey wey im comot from police hand before e do dis one again. Police bin detain am sake of defamation case against Burna Boy becos of video wey blow afta US rapper Diddy arrest. For one one viral video wey bin spread ontop social media, e show wia, Speed Darlington dey ask Burna Boy how e take win im Grammy award in 2021. Di 39-year-old wey pipo sabi as "Akpi" ask di Grammy award winner, Burna Boy if Diddy rub "oil for im nyash" bifor e win di trophy. "E no tey afta Burna Boy post im foto wit Diddy na im, e win Grammy," e tok "I just dey wonder, Burna Boy I dey ask you kwesion. No vex . How many oil Diddy drop for your nyash bifor dem give you trophy." Video of im arrest bin dey trend ontop social media, afta some pipo escort am comot from im gate. Meanwhile, di main pipo behind di arrest of 'Akpi', as Darlington dey call imsef no come out come tok. Afrobeats giant Burna Boy wey evri body dem call im name no also chook mouth for di mata. Who be Speed Darlington Speed Darlington na di son of Nigeria singer Pericoma Okoye, wey die on 16 February 2017 for Okigwe, Imo state Southest Nigeria. Im mama na Queen Theresa Onuorah. E blow for Nigeria afta im song BangDadaDang! comot for 2017 and pipo start to dey meme am for social media. E even tok say na Diddy bin inspire dat im song wen im drop am. Dat song blow sotay pipo even start to dey play am inside clubs and parties at di time and na wen Speed Darlington start im social media career. At di time wey e get im first hit, im bin dey live for di US but a few years later, e come relocate back to Nigeria. Di 39 year old rapper dey very popular for im social media persona wey im dey take tok about a lot of issues, mostly sex and how to make money.


BBC News
2 days ago
- BBC News
Why new political parties dey appear ahead of election year
Na two years remain for di 2027 general elections to happun but political association and politicians don begin prepare. One of di ways wey dem dey prepare na by forming associations wey fit later become political parties. On Wednesday June 26, di Independent National Electoral Commission confam say ova 100 associations don show interest to register as political parties ahead of 2027. "As of Monday, 23rd June 2025, di Commission don receive letters of intent from 110 associations wey wish to register as political parties. We dey take our time to process di requests in line wit di procedure outlined in law as well as our regulations and guidelines. We don acknowledge all requests wey we receive. "So far, we don acknowledge all applications we don receive, except for six, wey dem submit recently. We go acknowledge dem bifor di end of di week," Oga Mahmood Yakubu tok. Di commission also drop di full list of political parties wey apply for Inec registration ahead of 2027. Political parties na one of di pillars of democracy for any goment, and witout am elections no go fit happun to sustain democracy. Since Nigeria comot from military regime enta democratic rule fully for 1999 till now, di kontri don witness different political parties inside di multi-party system wey dem dey run. Why political parties full evriwia According to Inec, na 19 political parties bin officially dey dia register to contest for positions for di 2023 general elections. But wit di trend wey dey follow registration of political parties evri election year, e no go surprise pipo if by 2027 di political parties for Nigeria double. But why pipo wan register new parties evri time even wen dem no get any chance to survive di political terrain of Nigeria. Political analyst, Sani Bala tell BBC Pidgin why political parties dey full evriwia. Im tok say dis trend dey since and no be today e start - some of di reasons wey im give include na: Financial benefit: According to Mr Bala, bifor now, federal goment bin dey give political parties money during election time, especially di small-small ones wey no too strong. Di money na to encourage and support dem for dia expenses. "To run political party, you need some requirements, one of dem be say di political party gatz get office for Abuja, di Nigeria capital, and to get a place for office you need money. Di party need money for elections, campaigns, travels, even to print forms, so to support dem wit dis expenses na why goment bin dey give dem money. But some political parties just dey wait for dis money to come, afta election di parties go vanish, di good tin be say goment stop to dey give dem money since, na why di number no dey plenti like bifor again." Oga Bala add say dis political parties dey also make money from selling of expression of interest forms to candidates wey wan contest for different positions for election. Underground work for big parties: Di political analyst say most of dis small-small parties dey do underground work for di big parties. "E go surprise you to know say na some of dis big parties dey register di small political parties wey go do underground work for dem during elections". Dis small-small parties get agents for elections wey dey work for di big parties to secure votes." Political ideologies and negotiations: Mr Bala tell BBC Pidgin say anoda reason wey political parties dey full evriwia na sake of political ideologies and negotiations. Im explain say wen di big political parties fail to meet di ideologies of some big members dem go comot to create di one wey go fit dia political ideologies. Im also tok about di negotiation wey dey go on wit di small political parties about who go get ticket for which position. "Sometimes di pipo for di big political parties know say dem no go get ticket for di position wey dem wan run for, so dem gatz do bargain or merger wit dis small parties for future benefit". Political parties for Nigeria From di Third Republic, wey former military Head of State Ibrahim Babangida bin establish, na two political parties bin dey officially recognised. Dem be di National Republican Convention (NRC) and di Social Democratic Party (SDP). Sabi pipo tok say dis two-party system bin dey good well-well for Nigeria history and na during di transition time di parties bin come. Di fourth republic start from 1999. Between 1999 and 2015 Nigeria don get plenti political parties like di Peoples Democratic Party (PDP), di All Nigeria Peoples Party (ANPP), di Alliance for Democracy (AD). Since PDP come from 1999, dem still be one of di big political parties for Nigeria. Oda parties wey bin dey dat time na di United Nigeria Peoples Party (UNPP), di All Progressive Grand Alliance (APGA), di National Democratic Party (NDP), di All Peoples Party (APP), Action Congress of Nigeria (ACN), Congress for Progressive Change (CPC) and many more wey pipo no fit remember again. For more dan 25 years of democracy, di Peoples Democratic Party na one of di political parties wey don stand gidigba even as dem dey for opposition. Di ruling All Progressives Congress (APC) na coalition of oda parties wey join togeda for 2015.