logo
Cape Town gangs wey dey recruit small-small children into di gangs

Cape Town gangs wey dey recruit small-small children into di gangs

BBC News5 days ago

Di father wey still dey in shock lie down on one small single bed and e point to two bullet holes for di wall of im house.
Dis na clear evidence of di moment wey destroy im family life forever.
Dem shoot Devon Africa four-year-old son, Davin, for February, e bin dey di middle of one crossfire shoot-out between criminals.
E be victim of di gang warfare wey dey disturb Cape Flats, di towns around Cape Town – di area na legacy of apartheid, wen dem force non-white population comot from di centre of di wealthy city go di under-resourced outskirts.
"Dis na di bullet hole here," e tok. "Dis na wia e sleep."
Di family bin already don endure unspeakable horror.
Davin older sister, Kelly Amber, die two years earlier, dem shoot am too as rivals fire gun at each oda. She be 12.
Now, na only one pikin remain for Devon and im wife, Undean, dia youngest daughter.
"She ask me: 'Wia my brother dey?" Undean tok. "So I tell her say e dey wit Jesus for daddy heart and for my heart."
These murders happun for one area known as Wesbank, but many oda families across di wider Cape Flats area don at one time endure similar nightmares, despite assurances by di police say dem go increase patrols.
Di numbers tell horrifying story. Di Western Cape province – wia di Cape Flats dey - consistently see majority of gang-related murders for South Africa, according to di police.
Officially, dis na policing priority for di government. President Cyril Ramaphosa set up one special unit to fight gang violence for 2018, e also briefly deploy army to di area di following year, but di problem no stop, and di killings continue.
"Whole history and generations of pipo wey dem born into these gangs dey," Gareth Newham, head of di Justice and Violence Prevention programme for di Institute for Security Studies for Johannesburg.
"[Dem] flourish for areas wey di state don abandon or areas wey dey underdeveloped. Di gangs dey provide a form of social structure wey dey provide services to di communities wey di state no dey do anytin for. Dem dey provide food for homes. Money for electricity. Money for transport or funerals. These gangs even dey pay school fees."
Dem dey among di pipo for di community and "dat na why e dey very difficult for di police to tackle dem… e mean say dem fit use non-gang members' houses to store drugs and store weapons".
But pipo dey wey dey try tackle di issue.
Fifteen kilometres (nine miles) away from Wesbank na Hanover Park wia Pastor Craven Engel dey glued to im mobile phone almost all day, every day in im quest for peace.
Im mission na to mediate in gang conflicts to stop dis violence and di killings, wey profitable trade in drugs dey ginger. Im and im team dey try follow one basic formula: detection, interruption and changing mindsets.
"Hanover Park no really get any economy to tok of," Pastor Engel. "Most of di economy na from di drug culture. Dat na di biggest economy."
Pastor Engel say dem no fit overlook di impact of di apartheid for di area but neither can generational trauma - manifested as drug addiction and then family breakdown.
"Di substance [drug] create unemployment, di substance create robbery, e create gang fights sake of turfs. So, di substance dey di middle of so many of di atrocities within di community," Pastor Engel tok. E estimate say around 70% of local children wey dey there dey live wit some kind of addiction.
Dis community of around 50,000 pipo gatz endure shootings and stabbings almost daily. And most time, na young pipo dey do di killing and na dem dey die.
"Di policing approach alone no fit solve di problem bicos you fit arrest pipo bicos dem be members of di members, for having guns and for shootings and murders. Dem go go prison, but then, younger members go replace dem. And dat dey create a whole different set of problems. E dey likely say dem go get into fights ova territory and turf," Mr Newham tok.
"How dem dey shoot pikin seven times for head or three times for im back? How stray bullet take dey hit pikin?" Pastor Engel ask.
On im phone, e call community leaders and gang kingpins, wey dey constantly try to reduce di violence. Wen BBC Africa Eye visit am, e bin dey try broker one ceasefire between two warring gangs - and e bin manage to reach di jailed leader of one of dem.
"If I want something to happun then e go happun. You understand pastor?" di gang boss tok for phone. "But I fit tell you one thing. I be pesin wey like to fight back if I come under fire."
Threats. Even from behind bars.
But Pastor Engel no dey give up. E dey highly visible for im community, weda for di house of a parishioner or bifor im large and loud congregation for di pulpit on a Sunday.
"I think wetin make am dey very, very terrible now now na say more children dey involved for di gangs, bicos di gangs dey recruit between diages of eight and 15 years old," e tok.
Di programme e dey run bin dey receive government money, but di funds no dey again. To cut off di supply lines and protect di innocent, e go meet victims and perpetrators anywhere and at any time.
E dey also send rehabilitated gang members to negotiate directly wit warring factions. Those wey dey live on di edge of death know how important e dey to push for peace instead.
Glenn Hans na one such person. E dey meet wit rival gangs to convince dem to honour a ceasefire. "I bin also dey dis game. As long as you make decision say you wan be better pesin. Dat's all," e tell one group of gang members.
One of dem get chilling response: "Di more we kill, di more ground we seize and di more ground we get, di more we fit build. So, for me to speak about peace - I no fit make dat kain decision bicos no be my decision to ensure peace."
Di ceasefire wey dem eventually agree on bin last just for few days, shattered by di killing of two pipo for one drive-by shooting.
But some pipo wey don dey deep inside di conflict don get enough.
Fernando - or Nando - Johnston dey part of one gang called di Mongrels, and e dey try find way out wit di help of Pastor Engel.
Di pastor describe Mr Johnston as young pesin dem "born into di gang" since im whole family dey involved.
"For dis game na only two options dey – na either you go jail or you die, " Oga Johnston tok.
"I really wan change direction and I believe say way out always dey. Dat na di reason I approach di pastor - to ask am if plan or way dey to take me."
E go join one six- to 12-week programme of rehabilitation wey di pastor dey run and wey charitable donations dey fund wey dey designed to get pipo off drugs and into work.
"Di thing na you fit now start to dey build yourself up again," Pastor Engel tell am. "You go fit get job and make money for yourself. Then you no go need hustle and scavenge around here anymore."
"I ready to go, pastor," Johnston tok as e ready to leave im battered and scarred community in search of a new path.
Pipo wey close to am don gada to wish am well. Im mother, Angeline April, hold back her tears, desperate say, dis time, her son go choose life. "Please just make di best of dis opportunity, Nando," she tok.
"Yes mummy, I always make di best of a situation."
"Fernando papa na gangster but my oda children papa na gentleman," Mr Johnston mama tok.
"But bicos e be gangster, di children also chook body for gangsterism despite say I constantly dey warn dem. E no easy to raise four boys on my own, you know. I always dey encourage am to change, bicos I love am well-well."
And so far so good for Mr Johnston. Two weeks afta e start di programme, e still dey there.
"Nando dey stabilize. E dey for works programme. E dey see im family, e dey see im children. We allow am go house and e come back and we test am and no find drugs for im system," Pastor Engel tok.
Hope na rare commodity for here, but sometimes e dey spring through di cracks for di streets wey don see so much trauma.
No be all streets, though. Very little hope dey found at Devon Africa and Undean Koopman house, wey siddon for di middle of battlefield.
Di cycle of killings and retaliation wey don hit di area wey dey di edges of dis beautiful South African city dey overwhelming for many of those wey just dey struggle to survive.
And those caught in the middle often gatz make impossible choices.
"Community members, even if dem dey opposed to di gangs, are not necessarily pro-police for two reasons," Mr Newham tok.
"One na say dem no know if police go come if dem call dem. And if dem call di police, dem no know if di police officers dey corrupt. Pipo no understand di scale of di challenge for South Africa."
Sentiments reflected by di peacemakers on di frontlines for dis war. "Nobody go come from anywhere to help or save us. Not from overseas. Not from our local government. Nobody go come wit magic wand to cure di Cape Flats," Pastor Engel tok.
"As individuals we gatz dey determined to build up resilience, create hope for our pipo and grow. Bicos politics clearly don fail us."

Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

‘We are privileged': liberal Afrikaners reject Trump's ‘white genocide' claims
‘We are privileged': liberal Afrikaners reject Trump's ‘white genocide' claims

The Guardian

timean hour ago

  • The Guardian

‘We are privileged': liberal Afrikaners reject Trump's ‘white genocide' claims

For some white Afrikaner South Africans, Donald Trump's offer of refugee status in the US has been seen as a godsend. For others, it has provoked anger and frustration that they are being falsely portrayed as victims of a 'white genocide', 31 years after their community's own oppressive minority rule ended. In February, Trump signed an executive order claiming Afrikaners, who make up about 4% of South Africa's population, or about 2.5 million people, were victims of 'unjust racial discrimination'. The order cut aid to the country and established a refugee programme for white South Africans. The first group arrived in May. Afrikaners, descendants of Dutch colonisers and French Huguenot refugees who came to South Africa in the late 17th century, implemented apartheid from 1948. The regime violently repressed the black majority, while keeping white people safe and wealthy. South Africa remains deeply unequal. White South Africans typically have 20 times the wealth of Black people, according to an article in the Review of Political Economy. The spectacle of white people being flown to the US while Trump blocked refugees from war zones bemused and angered South Africans of all races. For some liberal Afrikaners, it felt personal. 'In terms of being singled out, for progressives it's extremely painful,' said Lindie Koorts, a history lecturer at the University of Pretoria. Koorts mentioned the phrase 'ons is nie almal so nie' ('we are not all like that'). She said the phrase is used by progressives to reach out across South Africa's divides without disavowing their Afrikaner or South African identities – despite it having become a cliche that conservative Afrikaners use to mock them. The rightwing Solidarity Movement, which includes a trade union and the campaigning group AfriForum, has lobbied Trump since his first presidential term for support in helping Afrikaners stay in South Africa, to preserve what Solidarity Movement says is a culture under threat. The group argues, for instance, that a recently implemented education law will limit Afrikaans schooling, something the ruling African National Congress disputes. There is not comprehensive polling data on Afrikaners' political views. However, the Freedom Front Plus party, which is seen as representing conservative Afrikaners, received about 456,000 votes in the 2024 national elections. Emile Myburgh, a lawyer who grew up during apartheid believing that Afrikaners were God's chosen people, said: 'I remember when I was a child often hearing Afrikaners say that: 'The one who rules the tip of Africa rules the world.' So we'd feel very special.' Sign up to Headlines US Get the most important US headlines and highlights emailed direct to you every morning after newsletter promotion As an atheist, Myburgh, 52, said he now felt excluded from the deeply religious community he grew up in. However, he disputed the claim that his culture was under threat, noting that he regularly attended Afrikaans book launches. 'In the circles that I move in, we do celebrate Afrikaans culture,' he said. Zahria van Niekerk, a 22-year-old fashion student, who was raised bilingually to help her get into university, disagreed that the Afrikaans language, of whom the majority of speakers are now non-white, was threatened. 'My whole family speaks Afrikaans … As long as I can speak it with my family, I'm not really concerned.' In May, Trump ambushed South Africa's president, Cyril Ramaphosa, in the Oval Office with claims that white farmers were being murdered for their race. However, Emil van Maltitz, an economics graduate and farmer's son, disagreed. The 21-year-old, who speaks Sesotho, Afrikaans and English, said: 'Most farmers are white Afrikaners, so it can easily be interpreted as racial targeting. I just think, personally, people are very vulnerable in those areas and they don't have a lot of help from the police.' In the last quarter of 2024, South African police recorded 12 murders on farms, including Black-owned smallholder plots, out of almost 7,000 murders across the country. Van Maltitz recalled young black farmers coming to his father to seek agricultural advice, saying it showed the value of South Africans working together. 'I love diversity, I love being around different people,' he said. Schalk van Heerden is a minister in the Dutch Reformed Church, the largest Afrikaans church. He joked that he was a 'missionary' within the DRC, which supported the apartheid regime. Van Heerden co-founded Betereinders in 2017 to bring about 50 to 100 Afrikaners to monthly brais (barbecues) with up to 200 black people in townships, where most black South Africans still live. Betereinders means 'better-enders' and is a pun on 'bittereinders' ('bitter-enders'), Afrikaners who refused to surrender to the British when their side lost the Boer war. When Trump introduced the refugee scheme for Afrikaners, Beterenders put up 10 billboards around Johannesburg and Pretoria saying, 'Not USA. You, SA.' Van Heerden said: 'We want to be proud about who we are … [But] we are not the big victims in this story. We are privileged, we are very grateful and we are thankful for everything we have.'

How children's social worker, 27, led a double life running underground drug and gun network... and made vulnerable kids DELIVER for her
How children's social worker, 27, led a double life running underground drug and gun network... and made vulnerable kids DELIVER for her

Daily Mail​

time4 hours ago

  • Daily Mail​

How children's social worker, 27, led a double life running underground drug and gun network... and made vulnerable kids DELIVER for her

Dedicating her career to supporting vulnerable children, Chloe Scott was once a pillar of her community. The London social worker, 27, boasted a dazzling CV centred around her experience in family safeguarding, protecting youngsters from harm. But in reality Scott was living a double life, running a large-scale drug and firearm supply network across the capital with her right-hand man Miles Addy. The pair sold cocaine and dangerous weapons across London and the south-east, including a gun used in a fatal shooting. Most shockingly, under the guise of a person who cared for children, Scott was secretly ordering a 15-year-old boy to sell and transport drugs on her behalf. This week she began a 12-year prison sentence after her twisted enterprise was exposed when the teen was stopped by police outside Tower Hill station in December 2022. Officers searched the youngster and found drugs and a mobile phone Scott used to instructing him how to help run her drug network. Armed Met Police officers stopped Scott's car in June 2023, finding around half a kilo of cocaine and five large hunting knives in her possession. As the investigation intensified, detectives discovered Scott was in regular contact with Addy, a convicted criminal in jail for a firearms offence. Addy was found to be directing Scott to various homes to deliver firearms and drugs to their customers. In a harrowing development, detectives later found one of the weapons was a firearm linked to a serious murder investigation. Meanwhile, another lethal firearm connected back to Scott and Addy was recovered during a warrant in November 2023. Joy Hyde-Coleman, 29, from Bow, was found to be in possession of the firearm and was later sentenced to five years in jail. Scott and Addy were charged in August 2024, as officers worked with authorities to suspend Scott from her trusted role as a social worker. Scott worked at various local authorities throughout her career, including a stunt at Bexley Council in south London, in 2023. 'Chloe Scott was a social worker supplied to us by an agency for a short period. 'We understand she has also worked at other local authorities,' a council spokesperson said. Scott pleaded guilty on the first day of her trial at Snaresbrook Crown Court, while her accomplice Addy pleaded guilty at an earlier hearing. Detective Inspector Damian Hill, from the Met's Specialist Crime team, said: 'As police officers we all too often see the devastating consequences of drugs and weapons on the streets of London. These dangerous offenders helped fuel violent crime and we won't stand for it. 'The overwhelming evidence we gathered, supported by British Transport Police and HM Prison and Probation Service left them with little choice but to admit to their offending and they will both now face lengthy prison sentences. 'Across the Met we remain committed to tackling violence and our hard work is paying off. Homicide and knife crime is down - and seen here we are also dismantling serious and organised crime groups.' Scott previously pleaded guilty to two counts of conspiracy to supply Class A drugs, two counts of selling or transferring a firearm, one count of conspiracy to possess firearms, one count of conspiracy to possess ammunition, and one count of possession of hunting knives. She also pleaded guilty to one count of causing unnecessary cruelty to a dog, showing just how far removed Scott really was from her caring disguise as a social worker. Meanwhile, Addy pleaded guilty to two counts of conspiracy to supply Class A drugs, one count of conspiracy to possess firearms, and a further count of conspiracy to possess ammunition at an earlier hearing at the same court and was recalled to prison.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store