
Di Nigerian police officer wey dey eye MMA history
Juliet Ukah na woman wey like to take charge and face huge challenges. Di Nigerian no only dey dominate for combat sports wey include taekwondo, boxing and kickboxing, but she dey also serve her kontri for her day work as police corporal.
Di 26 year old wey enta mixed martial arts (MMA) as reluctant stand-in fighter for 2023, dey about to turn part of history wen di Professional Fighters League (PFL) hold di first show for Africa for Cape Town on Saturday.
Ukah go join pipo like di popular 2024 European flyweight champion Dakota Ditcheva and middleweight title winner Johnny Eblen for di roaster for one of di most high-profile MMA events wey dem go hold for Africa.
Ukah tell BBC Sport Africa say, "I feel like queen and I feel good say I be di first African female fighter wey go dey signed to dey part of di PFL".
She add say, "somtin dey wey dem see in me wey make dem need to call me for di team".
Making a statement for Nigeria
Five years bifor she go start for di MMA, Ukah bin dey gingered to enta di Nigerian Police Force bicos of pipo like long jumper Chioma Ajunwa wey herself be officer and win di kontri dia first eva Olympic gold medal for di 1996 Atlanta Games.
All di six times wey she fight for MMA, she don win since di time wen she enta am becos of request by Henry George, wey be di president of di Nigeria Mixed Martial Arts Federation. E call her to replace fighter wey no come for card for Cameroon for April 2023.
She get her first knockout for DR Congo last June and now dey ready to face home fighter Ceileigh Niedermayr for strawweight showdown for di Grand Arena.
Ukah wen she dey tok about her unbeaten record tok say, "e mean a lot to me. Na joyful somtin to maintaim - e make me very happy so I wan add more".
She add say, "She [Niedermayr] also be beta fighter wey get good record. Di crowd go dey for her. But e no move me becos I dey use oda pipo fan do motivation."
George know how Ukah dey important as role model for female fighters and believe say her PFL debut go bring out "ogbonge statement" about how MMA dey gro for Nigeria.
E say, "e mean soo much to us. Dis go solidify her skills, justify all her sacrifices and confam say true-true she belong for di top. E go open doors for bigger opportunities for her to fit chase her goals for life and give am more recognition for her work".
'Opportunity for fighters dey here'
Di PFL start for US for 2017 and don alreadi get circuits for America and Europe togeda wit Middle East and North Africa league.
Dem make Cameroon born MMA fighter Francis Ngannou di Chairman for PFL Africa wen dem introduce am last year. E bin join di promotion afta e comot di UFC wia e be heavyweight champion.
Di PFL dey known for im tournament format, wey mean say fighters go get chance to advance for regular season, play-offs and championship stages so dem go fit reach finals and compete for title.
Loren Mack wey be di promotion senior vice president tok say, "di opportunity dey for fighters here for Africa to train, live and compete here for di biggest global scale wey di continent don eva see wen e come to combat sports".
Dem add say, "PFL Africa commitment to di continent of Africa na di biggest commitment for combat sports wey Africa don eva see."
PFL chief executive Peter Murray tell BBC Sport Africa wen dem first annouce plans say di promotion go invest for athlete development, coaching and training spaces under Ngannou leadership.
South Africa-born Frans Mlambo wey dey for di card for Cape Town don be long time sparring partner wit two time UFC champion Conor McGregor add say talent wey dey wait to dey discovered for di kontri dey "unbelievable".
Di first PFL Africa competition go get 24 fighters from 14 African kontris and dia second event go happun for Johannesburg for 9 August.
Ukah explain say, "di biggest challenges wey MMA fighters get for Africa na facilities, equipment and sponsors.
"PFL don enta di picture. E mean a lot to me bicos now I for start my career. Na ogbonge platform for me to show my talent."
Inspiring di next generation
Ukah, wey also dey play football and compete for track and field athlete say both her law enforcement and sporting roles fit dey hard.
She tok say she dey destined to be fighter as she add say, "I tank God say e gimme strength to manage di two becos e dey help me for hard times.
"My career as elite MMA athlete don really help me for police as e concern discipline and self-control.
"E dey also help me do well for work."
She go join Ditcheva of Manchester wey get perfect 14-fight record to do striking workshop wey dem go teach women for fighting week. Dis na wia PFL dey invite di public make dem learn new skills from pipo wey "dey rep di top of women MMA".
Ukah wan own gym and train odas. Her main dream na to teach women di value and disciplime of combat sports.
She explain say, "wetin inspire me to get career for combat sports na how dem dey treat women for society and how dem no dey hear women voices.
"I dey use my platform to take inspire women to fit train for self-defence and defend demsefs for society.
"I believe say wit my ability, I go fit inspire young women to pass wetin dem expect."

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


BBC News
3 hours ago
- BBC News
Gossip: Hull to sign winger Akintola
Caykur Rizespor winger David Akintola, 29, is expected to sign for Hull City after the Nigerian rejected an offer to stay in Turkey with Genclerbirligi. (Yagız Sabuncuoglu via X), externalWant more transfer news from the EFL? Take a look at Monday's gossip column here.


The Independent
4 hours ago
- The Independent
Next UFC Fight Night: Amir Albazi vs Tatsuro Taira start time, card and how to watch
The UFC is mixed martial arts' flagship promotion, home to some of the best fighters in the world. It stages events almost every weekend of the year, with pay-per-view cards taking place once a month on average – marking the company's biggest shows. Here is a look at the UFC's next event, including all the fights set to take place, what time they start and how to watch the card. Saturday 2 August – UFC Fight Night – UFC Apex, Las Vegas, US What time does it start? The prelims are due to begin at 11pm BST (3pm PT, 5pm CT, 6pm ET), with the main card following at 2am BST on Sunday (6pm PT, 8pm CT, 9pm ET on Saturday). How can I watch it? The card will air live on TNT Sports in the UK, with the broadcaster's app and website also streaming the fights. Discovery+ will also air the action in the UK. In the US, ESPN+ will stream the event live, as will the UFC's Fight Pass. Full card (subject to change) Main card Amir Albazi vs Tatsuro Taira (flyweight) Mateusz Rebecki vs Chris Duncan (lightweight) Elves Brener vs Esteban Ribovics (lightweight) Karol Rosa vs Nora Cornolle (women's bantamweight) Neil Magny vs Elizeu Zaleski dos Santos (welterweight) Danny Silva vs Kevin Vallejos (featherweight) Prelims Rinya Nakamura vs Nathan Fletcher (bantamweight) Rodolfo Vieira vs Tresean Gore (middleweight) Nick Klein vs Andrey Pulyaev (middleweight)


The Sun
21 hours ago
- The Sun
UFC star reveals she needs SECOND eye surgery after being rushed to hospital following Abu Dhabi defeat
UFC star Amanda Ribas is set to undergo her SECOND eye surgery after being rushed to hospital following defeat in Abu Dhabi. Ribas - who went under the knife in 2023 for a broken orbital bone - was stopped in round two against Tabatha Ricci. 3 The Brazilian was dropped with an elbow and finished on the floor. But the elbow landed on the same area as her previously broken orbital and will now require a titanium plate. Ribas, 31, posted on Instagram: "It wasn't the result I wanted, but I know it's what I love! "It's where I love to be, it's where it makes my eyes shine, and I get paid very well for it. "Thank you to God for the opportunity to work with what I love and to @ufc. "I'm going to have surgery soon, on top of the one I already had on my facial bone. "God continues to be wonderful to me and is in control. Prayers." Ribas was not the only one to suffer a horror eye injury on the Abu Dhabi card. CASINO SPECIAL - BEST CASINO BONUSES FROM £10 DEPOSITS Mohammad Yahya was left with gruesome swelling to his left eye - with fears he could lose his vision permanently. Yahya was beaten by Steven Nguyen in a featherweight bout that broke the UFC record for most knockdowns in a fight with six. A health update was revealed after the bout on the UFC broadcast - with Yahya not suffering any facial fractures. He also was cleared of any more lasting damage as CT scans came back clear in the immediate aftermath of the bout. 3